BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Police sama Fulafia lecturer and im three pikin wit charges sake of viral assault video

31177284 File photo

Mon, 24 Oct 2022 Source: BBC

Police for Nasarawa State, North Central Nigeria, don sama Dr Fred Ekpa Ayokhai and im pikin dem wit charges afta video show dem dey beat one 20-year-old Blessing Mathias wey dem also naked. Di tok-tok pesin for di State Police Command, DSP Ramhan Nansel, tell BBC Pidgin say dem go arraign dem for court on 25 October or 26 October. E say di charges wey dey hang around dia neck na charges of inflicting physical injury on anoda pesin contrary to section 2 of VAP Law, kidnapping wey dey contrary to section 3 of di Anti-Kidnapping Law of Nasarawa State, assault to woman with intent to outrage modesty wey dey contrary to section 268 of di Penal Code and posting of nudes and pornography on internet wey dey contrary to section 24 of Cybercrime Act. Video wey show di associate professor for di Department of History and International Studies of Federal University of Lafia (Fulafia) and im pikin bin dey assault Blessing go viral and make pipo vex on social media last Saturday. Police bin arrest di lecturer and im daughter Emmanuella on di same day di video go viral, and dem seize di vehicle wey dem take carri di victim go one location wia dem assault am. For anoda statement, DSP Nansel confam di arrest di two sons of di lecturer, 23-year-old Bob and 21-year-old Saint-Dan.

Police for Nasarawa State, North Central Nigeria, don sama Dr Fred Ekpa Ayokhai and im pikin dem wit charges afta video show dem dey beat one 20-year-old Blessing Mathias wey dem also naked. Di tok-tok pesin for di State Police Command, DSP Ramhan Nansel, tell BBC Pidgin say dem go arraign dem for court on 25 October or 26 October. E say di charges wey dey hang around dia neck na charges of inflicting physical injury on anoda pesin contrary to section 2 of VAP Law, kidnapping wey dey contrary to section 3 of di Anti-Kidnapping Law of Nasarawa State, assault to woman with intent to outrage modesty wey dey contrary to section 268 of di Penal Code and posting of nudes and pornography on internet wey dey contrary to section 24 of Cybercrime Act. Video wey show di associate professor for di Department of History and International Studies of Federal University of Lafia (Fulafia) and im pikin bin dey assault Blessing go viral and make pipo vex on social media last Saturday. Police bin arrest di lecturer and im daughter Emmanuella on di same day di video go viral, and dem seize di vehicle wey dem take carri di victim go one location wia dem assault am. For anoda statement, DSP Nansel confam di arrest di two sons of di lecturer, 23-year-old Bob and 21-year-old Saint-Dan. Ref: AZ:5250/NAS/PRD/VOL. 2/007 Date: 22/10/2022 POLICE PRESS RELEASE In continuation of the relentless pursuit of all suspects connected to the case of assault that was captured in a video that has gone viral, be informed that the duo of Bob Praise Ayokhai 23yrs, a 300 level — Nasarawa State Police Command (@NAS_PoliceNG) October 22, 2022 Wetin dem do Blessing MathiasFor inside di video wey go viral, Dr Fred, im daughter and im two sons bin storm Blessing house early morning to assault am sake of say Blessing bin beat Emmanuella becos she see her boyfriend phone number for her phone. Blessing neva wear her trousers before di family start to dey beat am wit hand, wood and oda materials. Dem lead am outside and tell am to lie down. Di young lady bin dey beg Emmanuella but she no gree and di beating continue while one of di man pikin dey record di assault. Dem carri Blessing for one Ford SUV wey belong to Dr Fred and drive am go one location along Kwandere road where dem continue dia assault on di victim. Inside di car, Blessing wey dey cry still dey beg Emmanuella but di lady still no gree. Dr Fred carri scissors and begin tear Blessing cloth till e naked di young lady. Afta dem naked Blessing, dem kon abandon am for inside bush. 

Source: BBC