Popular Nigerian evangelist, Dr Uma Ukpai don die
One popular Nigerian evangelist and di leader of di Uma Ukpai Evangelistic Association, Dr Uma Ukpai don die, im family confam.
Di Ukpai family tok am for inside statement on Monday, wey dem reveal say e don even die since October 6, 2025 at di age of 80.
Dem add say say dem dey grateful for di life and work wey im do ova di course of 60 years add say even as dem dey mourn am dem happy say e don "finish im race and now dey rest for eternal praise".
Howeva, dem neva tok plans for im burial arrangements, say dat one go come afta.
Wetin dey clear be say e don help plenti pipo.
Di statement tok say e "dedicate ova six decades of im life of beta evangelism, correct teaching of di Word and prophetic demonstrations of di power of God, e bin impact millions of lives and change lives and destinies for Nigeria and world wide".
Plenti ministers don dey react to di tori of im passing as e dey comot.
Apostle Emmanuel Iren of Celebration Church hail Dr Ukpai as im say, "Thank you for giving to di Lord and im Church".
Apostle Johnson Suleman tok say, "e tanda gidigba and teach us mission. Good night General sir".
Christian artiste, Prophet Joel Ogebe hail Dr Ukpai even as e admonish oda pastors say, "di rising ministers of Akwa Ibom, Uyo, di baton don dey passed".
Rev Dr Uma Ukpai biography
Dem born Dr Uma Ukpai for 7 January, 1945 for Abia State but den at di age of 10, im lose im papa.
For di 1970s, e come bicom di founder and president of Uma Ukpai Evangelistic Association (UUEA), wey be non-denominational gospel ministry wey di headquarters bin dey for Uyo, Akwa Ibom state.
E also collabo to start di Pentecostal Fellowship of Nigeria, PFN togeda wit oda big men of God like Bishop Ben Idahosa, Pastor Enoch Adeboye among odas.
Tori be say na im Greater Lagos for Christ Crusade of 1985 born di Pentecostal Fellowship of Nigeria.
Dr Ukpai na graduate di School of Journalism and Television, Frisham, Hermitage, United Kingdom. E also go di South Florida Christian College for US togeda wit Carolina Christian University, and Burke Bible College, Kentucky.
From dis schools, e gbab diploma for Journalism, certificate for Electrical Engineering practice and Bachelor and Doctorate Degrees for Divinity.
Howeva, no be only good tins don happun to am. E bin lose two of im nine pikin for di same day and na wetin e dey use to normally preach as test of faith.
E don host many crusades for many cities all ova Nigeria like di yearly, Greater Ohafia For Christ Crusade, Anioma One-million Man Crusade for 2016 among odas.
E bin dey also work as di chairman for Uma Ukpai Eye Centre, for King of Kings Hospital, wey be specialist hospital for Abia State.
E bin marry in wife Philomena Ukpai for 1975 and dem don born eight pikin and adopt one join.
For one interview, e tok about im wife say, "wen you marry good wife, many tins dey possible. Woman wey go go create problems for you, woman wey go give you peaceful atmosphere, woman wey go give you beta food bicos na good food dey give you strong life and strong life dey lead to long life."
For November 2008, e put down foundation for di first building of Uma Ukpai School of Theology from leading wey im bin get di year bifor.
According to di school website, e bin envision di school as place wia Pastors and young pipo dem fit learn. Di plan of di school na to "combine training of pastors , wit business and vocation as some kain skill acquisition."
Di school dey offer Bachelors Degree for Religious and Cultural Studies as well as Bachelors and Post Graduate courses in Theology. Dem also get Computer Programmes.