Di Presidency for Nigeria don apologise to citizens ova di errors wey dem make for di list of appointments wey dem release.
According to wetin di Special Adviser on Media and Public Communication to Nigeria President tok, dem notice errors for di list.
Dis dey come afta di presidency bin release list of pipo wey President Bola Tinubu don appoint since e enta office, sake of how some critics tok say im cabinet dey one-sided
Critics and opposition say di President of Nigeria no appoint pipo according to federal character.
Some say di political appointments of Tinubu dey favour some parts of di kontri pass di oda and dat no be wetin di constitution tok.
Recently, Senator Ali Ndume wey dey represent Borno South Senatorial District under All Progressives Congress (APC) tok for im TV appearance say di President appointments suppose reflect federal character according to section 14(3) of di Nigeria Constitution.
Meanwhile, section 14 (3) of di Constitution tok say "di composition of di Govment of di Federation or any of di agencies and di conduct of dia affairs shall dey carried out in such a manner wey go reflect di federal character of Nigeria and di need to promote national unity, and also to command national loyalty"
Di section add say "e no go get any predominance of pesins from a few State or from a few ethnic or oda sectional groups for dat Govment or in any of dia gencies.
According to Ndume, im say im duty na to call di attention of di President to di issues wey dey according to di Constitution so e no go backfire later.
Howeva, Ndume and Tinubu dey same party and e say make e correct am.
Im add say, im know say "Tinubu boys go start to dey attack me instead make dem focus on di facts" but im go tok di facts as im be one of dose wey dey close to di President.
"Di constitution dey clear say appoint suppose reflect federal character but dat no be di case for here."
"Na wetin I dey call di attention of Mr President to such tin so e fit correct am becos e fit bounce back."
For dia attempt to counter di tok say President Tinubu dey favour one side of di kontri pass di oda im media pipo release list of appointments wey e don make so far and dia geopolitical zones.
Meanwhile, some pipo note say di list no dey correct and complete as some major appointments dey miss.
Di list no contain di name of Chief of Staff to di President, Femi Gbajabiamila, wey be from di Southwest region- same region wey Tinubu come from.
Na as dis tok dey go on, some pipo drag di govment say im gatz make all di zones for di kontri dey well represented for im administration in terms of appointments into agencies and ministries.
"We don notice a number of errors for di list of appointments wey we tweet. We dey sorry. We go provide an updated list later. Tank you," Presidency tok.