Menu

President Tinubu speech on Nigeria Independence Day

Bola Ahmed Tinubu Bola Ahmed Tinubu Bola Tinubu Bola Tinubu Nigeria President Bola Tinubu

Tue, 1 Oct 2024 Source: BBC

Nigeria President Bola Tinubu don announce di gathering of a National Youth Conference to address di different challenges and opportunities wey dey face young pipo for di kontri.

President Tinubu tok wen im address di nation for im second Independence Day Broadcast and Nigeria 64th anniversary say di conference go "provoke meaningful dialogue and empower our young pipo to participate actively in nation-building."

E say dis go dey possible by by ensuring say dia voices dey heard in shaping di policies wey dey impact dia lives.

Di Confab go last for 30 days and e go touch on issues like education, employment, innovation, security, and social justice.

Di president add for im address say di details of di Confab and selection of di delegates go dey designed in close consultation with di young pipo through dia representatives.

President Tinubu say government go soon announce all di beneficiaries of di national honours for 2024.

E confam say di Senate President and di Chief Justice of the Federation don get di honour of the Grand Commander of the Order of the Niger (GCON). Di deputy Senate President and Speaker of the House of Representatives get di honour of Commander of the Order of the Federal Republic (CFR), while di deputy speaker of the House do dey awarded Commander of the Order of Niger (CON).

Di president broadcast also touch on di high cost of living for di kontri, di economy and security.

We still dey update dis tori.

Source: BBC