Katie Evans bin dey relationship wit one prisoner for HMP Doncaster
One former prison officer wey bin get "intimate" relationship wit one inmate don chop 21 month sentence to go chill for prison.
Mama of one pikin, Katie Evans, 26, bin dey "corrupted" by robber Daniel Brownley not long afta she begin work for HMP Doncaster, Sheffield Crown Court hear on Tuesday.
Evans, of Hatfield for Doncaster, bin get more dan 140 phone calls wit Brownley, move money around accounts for am plus boast of performing sex act, di court hear.
Judge Jeremy Richardson KC say e n get any "excuse" for her offending, even though na "experienced criminal manipulated am".
Evans agree say "intimate" relationship dey between dem, but e no clear weda she bin accept say e dey sexual.
Prosecutor Matthew Burdon bin don first tell court say Evans boast give one former prison officer say she perform sex act on di inmate.
Di judge hear di defendant refer to herself as "your queen" wen she dey tok to Brownley.
'Young and immature'
Judge Richardson tell Evans: "E be like say you bin do some kain sexual activity for di prison.
"Na truly terrible situation for one judge to dey pass sentence on a former prison officer wey dem brand corrupt prison officer."
Im add: "I dey entirely satisfied say experienced criminal manipulate you to assist am.
"Your misconduct materially affect di good order and discipline of di prison."
Di judge say Evans bin dey "young and immature" di time wey she bin commit di offence for 2020 and say she "regrettably dey exposed to manipulation".
"You no get experience and dey immature but dat, however, no be excuse for wetin you do," im tell her.
E say im accept say she dey genuinely remorseful and no be danger to di public foyfuture.
'Merciful' sentence
Judge Richardson say Evans sentence of 21 months suppose dey longer but, "purely as act of mercy", im reduce am.
Im cite di effect wey e go get on Evans relationship wit her young daughter and di difficulties she go experience for prison as a former officer.
Evans admit to misconduct for one public office for one former hearing.
She cry and wave at family members for di public gallery as dem lead her from di dock.
Di court hear say Brownley bin don first go prison for five-and-a-half years for 2016 for attempted robbery, burglary and handling stolen goods.
Dem bin release am but im go back to prison for 2020 afta dem call am back for breaching im licence conditions.
'Zero-tolerance'
Det Con Scott Jarvis say Evans bring "shame on di profession".
"Pipo like Evans wey dey undermine public trust wen dem hold positions of authority go dey dealt wit by di full force of di law," im add.
Im thank di staff for Serco, di owner of di prison, for cooperating wit di investigation.
One tok tok pesin for di company say e get "zero-tolerance approach" to staff whey no meet expected standards.
Dem add: "On dis rare occasions wen one of our officers fall short of di required standards, we dey work closely wit di police to investigate di issue fully and wen necessary take appropriate action.”