Bandits don attack mosque for Unguwan Mantau community, Malumfashi Local Govt Area for Katsina State
Bandits don attack mosque for Unguwan Mantau community, Malumfashi Local Govment Area for Katsina State, northern Nigeria, and kill plenti worshippers and injure odas.
According to one resident wey follow BBC News Pidgin tok, na 25 worshippers di bandits kill and na five pipo dem injure.
Di eyewitness wey no want make we mention im name say di attack happun around 6am for morning afta pipo finish dia Fijr prayer.
"Around 5:45am, di gunmen meet pipo for mosque afta dem finish Fijr prayer, dem just open fire on dem.
"Na immediately 25 pipo die, and more dan five odas injure, dem dey receive treatment for Katsina hospital now," e tok.
E add say wen di attack dey happun, dem no get any help from security pipo.
"Na afta di gunmen finish to kill pipo bifor security officers come. Dem snap picture and within two hours, dem don waka comot," e tok.
E add say since afta di attack, pipo dey live for fear, and some don run comot from di community to save dia lives.
"As I dey tok to you now, all my family no dey house again, dem don run comot for di community, pipo wey remain no plenti," e add.
Di resident beg di state govment and security pipo make dem help bring peace for dia community.
"13 residents lose dia lives" - Katsina State govment react to di attack
Meanwhile, di Katsina State govment don announce immediate security reinforcements and support sake of di tragic incident wey happun for Unguwan Mantau community, Malumfashi Local Govment wia di incident happun.
Di state govment through di Commissioner for Internal Security and Home Affairs, Dr. Nasir Mu'azu, say na '13 residents lose dia lives during morning prayers' wey di attack take place.
"Di incident bin occur wen criminal elements launch reprisal attack on di community. Di Muslim members of di community bin dey pray for di mosque during di Fajr prayer wen di criminal element bin start dey shoot anyhow for di mosque," di commissioner tok.
E say di attack na retaliation sake of di 'successful defence efforts' wey di community do two days bifor wia di "pipo of Unguwan Mantau decide to lay ambush against di bandit and kill many of dem.
Di commissioner say di community residents bin rescue di victims wey di bandits don take from Ruwan Sanyi village and recover motorcycles.
"Di security agencies now dey on ground for Unguwan Muntau to restore normalcy.
"Nigerian Army, and Nigerian Police Force don alreadi deploy to clear dose bandits becos during di rainy season, bandits dey hide under di crops to do dia evil acts."
Katsina State govment say dem dey work to make sure say dem bring di bandits to face di law.