Cristiano Ronaldo don become football first billionaire player, according to financial information and media firm Bloomberg.
Di Bloomberg Billionaires Index, external wey dey track di world richest pipo based on dia net worth, don measure di 40-year-old Portugal and Al-Nassr striker wealth for di first time.
Di valuation bin take into account career earnings, investments and endorsements and dem say Ronaldo net worth na $1.4bn (£1.04bn).
Dem tok say e earn more dan $550m (£410m) in salary between 2002 and 2023, and dem break down im reported earnings through deals and sponsorship, wey include one decade-long deal wit Nike wey worth almost $18m (£13.4m) a year.
Click here to join BBC Pidgin Whatsapp Channel
Court adjourn decision on Nnamdi Kanu health mata to anoda date
Inec appoint May Agbamuche-Mbu as acting national chairman
Wen Ronaldo join Al-Nassr for di Saudi Pro League for 2022, e reportedly become di best-paid player in football history wit annual salary of £177m.
Im contract suppose end for June 2025 but e sign one new two-year deal – wey reportedly worth more dan $400m (£298m) – wey go keep am for di club beyond im 42nd birthday.
Argentina and Inter Miami forward Lionel Messi, wey play against Ronaldo for many years during dia time for Spain, earn more dan $600m (£447m) in pre-tax salary during im career, according to Bloomberg.
Dat include $20m (£15m) in guaranteed annual pay since 2023, wey be about 10% of Ronaldo income during di same period.
Wen e retire, 38-year-old Messi dey set to get a stake in Inter Miami.
Man drag Cristiano Ronaldo go court because e endorse Binance
When Ronaldo go play im first game for Al Nassr as e land Saudi for official unveiling?
Ghana vs Central African Republic: Blackstars get chance to seal dia 2026 World Cup destiny