Menu

Russia President Putin clear im mind on di ceasefire proposal for Ukraine inside key press conference

Vladimir Putin Vladimir Putin Vladimir Putin Vladimir Putin  Vladimir Putin Russia President Vladimir Putin

Fri, 14 Mar 2025 Source: BBC

Russia President Vladimir Putin say di whole idea of ceasefire as United States and Ukraine dey suggest dey good, but dem still need to tink di tin well.

Putin tok dis one as im dey respond to tori pipo for one Press Conference wey im bin do wit Belarus President, Alexander Lukashenko, for Moscow.

E say im agree to stop fighting Ukraine but any ceasefire wey go happun must lead to long-standing peace.

Di Russian president say im still need to tok more wit President Trump through phone as im get questions wey im need ansa to.

One of dis question na, dis 30 day ceasefire, wetin exactly Ukraine wan carry am do? Dem wan use am reequip?

Putin also say im wan know "Who go give orders to cease hostilities, and wetin dis orders go worth?"

E also ask, who go decide wia "violation of possible ceasefire agreement" don occur along 2000km (1242.7 miles) of border between Russia and Ukraine.

"All dis tins go need to dey carefully studied by both sides," as im insist say di idea of a ceasefire dey "good and we absolutely support am but e get issues wey we need to discuss".

"We need to negotiate wit our American colleagues and partners" and "maybe" have phone call wit US President Donald Trump.

"Di very idea of ending dis conflict by peaceful means, we support am."

Trump react to wetin Putin tok

Reacting to wetin Putin tok, United States President Donald Trump say im go love" to meet wit Russian President Vladimir Putin to discuss more on di ceasefire deal.

But add say "we have to get over wit am fast."

Di US president tok dis one for Oval Office during im meeting wit Nato secretary-general Mark Rutte.

Trump add say im get "pipo wey dey tok for Russia" - US envoy to Russia Steve Witkoff dey meeting currently for Moscow.

"Ukraine don agree, subject to wetin dey happun today, to complete ceasefire and we hope say Russia go do di same," Trump continue.

E say di war for Ukraine na "big cost to United States and oda kontris".

Wetin putin position on di ceasefire proposal tell us about wetin e dey tink?

Putin position on dis proposed ceasefire for Ukraine dey show say, afta three years of war, Kremlin dey more dan capable of practicing clever diplomacy.

On one hand, im be like im dey give positive response to di US proposal for immediate stop to all di fight fight.

A direct "no" for affect di relationship between di Kremlin and di White House – relationship wey dem just recently dey try to improve and, in recent weeks, don mainly work in Moscow favour.

On di oda hand, agreeing to ceasefire without any condition, from Russia perspective, go make dia position weak for battlefield.

Putin words, plus im unannounced visit yesterday to Kursk region – wia im bin show in rare appearance inside military uniform – na reminder say success for battlefield remain priority for Moscow.

Also e still never clear how far White House dey willing to go to persuade Ukraine to accept Russia demands.

Trump don warn say rejecting ceasefire go bring "devastating consequences" for Russia, even as im admit say Russia get all di cards, while Ukraine no get any card.

So, wetin exactly dat one mean - and which kain advantage U.S. dey prepare to use for dealing wit Moscow - e remain mystery.

Source: BBC