Di Minister of Innovation, Science and Technology, Geoffrey Uche Nnaji don resign
Di Minister of Innovation, Science and Technology, Geoffrey Uche Nnaji don resign.
Im resignation dey come afta one Premium Times report allege say di minister forge im University degree certificate and im NYSC certification.
Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga for statement on im official X account, confam say President Bola Tinubu don accept di minister resignation.
According to di statement, e resign on Tuesday, 7 September for inside one letter to di president, and e thank am for allowing am to serve Nigeria.
"President Tinubu thank am for im service and wish am well for im future endeavours," di statement add.
Na for August 2023, President Tinubu name am among di first batch of 28 ministerial nominees from 25 states, and e forward im name go di Senate for screening and confirmation.
Oga Nnaji bin dey eye of di storm on top accuse say e forge di credentials wey e submit give President Bola Tinubu and di senate during im ministerial screening and confirmation.
One investigation wey Premium Times Newspaper publish allege say di minister no complete im complete university education, and say both di bachelor degree and National Youth Service Corps (NYSC) discharge certificate e dey parade up and down na fake.
Oga Nnaji don deny dis accuse.
For one news conference wey di Minister office arrange for Monday, 6 September for Abuja, im tok-tok pesin Robert Ngwu tell tori pipo say di report by Premium Times na lies.
E say im be target of blackmail, and na im political opponents set am up.
"Chief Uche Nnaji na proud alumnus of UNN, as e graduate for July 1985 wit a B.Sc. Degree for Microbiology/Biochemistry, wit second class (honours) lower division," Ngwu tok.
E also refer tori pipo to one letter by one former registrar of UNN on December 21, 2023, wey confam say Uche Nnaji bin graduate for di school.
"Two years later, in May 2025, one purported letter bin surface - wey di university allegedly write - wey suddenly claim say dem no get records of di Minister graduation. Di question wey evri Nigerian suppose ask na: Wetin change between December 2023 and May 2025?" Ngwu tok.
Di minister tok-tok pesin also say di minister bin carry di mata go court wia di court bin give order to UNN, on 25 September dis year, for dem to release im academic transcript, among oda tins. But until today, di university neva release di transcripts.
During di press conference, BBC News Pidgin tori pesin ask di minister tok-tok pesin, wetin dem get to tok about di allegation of NYSC certicate forgery wey Premium Times claim, and e say dat one na "non-issue", bicos Premium Times for dia so-called investigation bin no publish any letter by NYSC wey tok say di minister bin no do im National Service.
"Di minister serve im kontri wela for Plateau State and dat one no dey in contention," Ngwu tok.
Although, for di PT investigation, dem show some differences wey dey for di NYSC certificate wey di minister bin present give di Senate during im screening, wen you place am side by side wit oda NYSC certificates wey dem issue for di same 1986 wey di minister claim say im serve.
PRESIDENT TINUBU ACCEPTS RESIGNATION OF GEOFFREY NNAJI AS MINISTER
— Bayo Onanuga (@aonanuga1956) October 7, 2025
President Bola Ahmed Tinubu has accepted the resignation of Geoffrey Uche Nnaji, the Minister of Innovation, Science, and Technology, following some allegations against him.
President Tinubu appointed Nnaji in… pic.twitter.com/Klp7mpDXsc