Menu

Search and rescue begin as seven-storey building collapse for Kenya

Kenya Building Di collapsed building

Sun, 20 Oct 2024 Source: BBC

Govnor of Nairobi Sakaja Johnson say so far, authorities don record one casualty for di building wey collapse for Kahawa west.

Di govnor wey give situation update on di collapse of one seven-storey building wey happun on Sunday 20 October around noon, say di casualty na one middle aged woman bin dey outside di building wen di incident happun.

"So far, na only one casualty dey reported; one middle aged lady, wey dey outside di building, she bin fall and injure wen di building collapse. She currently dey receive treatment and she dey stable."

Nairobi City County and Multi Agency rescue teams still dey carry out search and recue operations for di site of di collapsed building, plus dem don gada all di equipment dem go need for di area, e tok.

Di govnor add say dem no dey expect many casualties as di Nairobi City County Planning Enforcement team bin don order pipo to evacuate di building a week bifor di collapse.

Wetin we know about di building

Nairobi county evacuation notice on collapsed building Wia dis foto come from,Sakaja Arthur Johnson/X

Di seven-story building na one housing unit for Kahawa West area, edey for plot n0. 233, along station road.

Di building get plenty apartments for residential purpose and business.

According to di govnor, di county planning department last week bin ask families to evacuate from di building.

One video wey dey go viral for social media bin show how di building take collapse.

Di video bin show how children and pipo wey dey close to di building run as di building dey crash down.

However, number of casualties neva dey known Nairobi county teams still dey on ground to rescue pipo from buildings wey dey close to di one wey collapse.

Skip Twitter post, 2

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Accept and kontinu

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 2

Kenya Red Cross wey also confam di incident, tok say fear dey say many pipo dey trapped for di building.

For one statement on dia X account, di agency say emergency team currently dey di scene to rescue those wey dey trapped.

The Star report say police tok say dem no dey sure if pipo dey trapped under di rubble afta di collapse.

Nairobi police boss, Adamson Bungei say residents bin don evacuate di house.

“We no dey sure if pipo still dey di house, but I know say evacuation happun, e tok.”

E add say dem don send teams go di site to rescue pipo wey fit dey trapped.

Source: BBC