BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Seven pipo die for second California shooting in three days

Di arrest of di suspect for di Half Moon Bay shootings

Tue, 24 Jan 2023 Source: BBC

One gunman  don kill seven pipo before Police arrest am for California on Monday, just two days afta one shooting kill eleven pipo for one popular dance hall.

Di latest attacks happun for two separate locations for di coastal city of Half Moon Bay, about 30 miles (50 km) south of San Francisco.

Dem identify di attacker as 67-year-old Zhao Chunli, one local resident.

Dis dey come as di state dey mourn di deaths for majority-Asian Monterey Park during celebrations for di Lunar New Year.

News camera bin film di suspect on Monday wen im dey handover imsef  to di San Mateo County Sheriff's Office about two hours afta di attack.

Dem discover di first four victims for one mushroom farm around 14:22 local time (00:22GMT), while dem see di oda three later for one  nearby trucking business.

Investigators neva provided any reason for dis attack yet.

San Mateo County Sheriff Christina Corpustok for news conference say dem arrest di suspect afta im drive imsef to one local police station around 16:40.

Im bin dey wit one semi-automatic pistol wey be like wetin im use for di attack, and im dey currently "co-operate" wit police, she tok.

Mrs Corpus add say dem dey treat di eighth victim for hospital wey dey in critical condition."Dis kind of shooting dey horrific," she tok. "Na tragedy we dey hear about too many times now, but today e hit home hia for San Mateo County.

"For news conference, di sheriff also confam say witnesses include children wey just comot from school recently wey dey live for di rural property."For children to witness dis dey unspeakable," she tok.

California Govnor Gavin Newsom tweet say im bin go "di hospital  to meet wit victims of di mass shooting wen dem drag am go corner to brief am about anoda shooting."Dis time in Half Moon Bay.

Tragedy upon tragedy."Half Moon Bay Council member Debbie Ruddock tell NBC say di victims na Chinese farmworkers.

San Mateo County Board of Supervisors President Dave Pine tell di Associated Press news agency say na one “worker wey dey vex” cari out di attacks”. All of usdey sick sake of di tragedy wey happun today for Half Moon Bay," Mr Pine tok for statement."Di scourge of gun violence don sadly hit home. We neva even get time to mourn di pipo wey die for di terrible shooting in Monterey Park. Gun violence must stop."

Source: BBC