Menu

Seven pipo wey play key role for di freedom of Nigeria

Screenshot 2024 10 01 174032.png Sir Ahmadu Bello di north Nigerian premier, Chief Abafemi Awolowo di western leader, and Dr. Ndamdi

Tue, 1 Oct 2024 Source: BBC

Nigeria celebrate 64 years of independence on 1st October.

Di kontri gain independence from Britain for 1960.

BBC torchlight seven ogbonge pipo wey play key role for di struggle for freedom of di kontri:

1. Nnamdi Azikwe (16 November 1904 - 11 May 1996)

Chief Benjamin Nnamdi Azikiwe na di first president of Nigeria afta di kontri become republic.

Bifor dat time, im bin be di first black Govnor-General of Nigeria from 1960 to 1963.

Dr Azikiwe wey dem bin sabi as di "Zik of Africa," na di leader of modern day nationalists.

Im bin be one of di main pipo wey fight against British colonial rule

Nnamdi wey bin be journalist and di founder of di West Africa Pilot newspaper, use di paper as powerful weapon to fight di colonialists.

Im be di first Nigerian to join di United States Congress.

Afta dem declare Nigeria as a Republic, Dr Nnamdi Azikwe do im best to unite di kontri.

Nnamdi Azikiwe foto dey for Nigeria currency, di N500 note.

2. Chief Anthony Enahoro (22 July 1923 - 15 December 2010)

Chief Anthony Eromosele Enahoro na one of di prominent anti-colonial activists and a pro-democracy activist.

Oga Enahoro become di Editor of Nnamdi Azikiwe Southern Nigerian Defender newspaper, and tori be say im become di youngest newspaper editor in Nigeria.

Enahoro na di first pesin to submit request for di independence of Nigeria for 1953. Dat na why dem dey call am "Father of Nigeria".

Chief Enahoro na scholar and im campaign for Nigeria until im die for 2010.

3. Herbert Macaulay (14 November 1864 - 7 May 1946)

Im full name na Olayinka Herbert Samuel Heelas Badmus. Na patriot, politician, engineer, architect, journalist and a poet.

Many Nigerians describe am as di leader of di kontri patriots.

Oga Macaulay bin popular on to say im bin dey against British colonial rule.

For 1919, im bin defend royalists in London wen dem bin seize dia farms, na im force di British colonial goment to pay plenty compensation.

Dis one vex di British Council to di extent dat dem imprison am twice.

Macaulay become popular wen im form im first political party on June 24, 1923 for Nigeria, di Nigerian National Democratic Party (NNDP).

Herbert Macaulay die for 1946. But im picture dey for di old ₦1 naira note for Nigeria currency.

4. Chief Obafemi Awolowo (6 March 1909 - 9 May 1987)

Chief Obafemi Jeremiah Oyeniyi Awolowo na patriot and elder wey play important role for di struggle for independence of Nigeria.

Na im be di first premier of di South West region of Nigeria and tori be say im serve as di finance commissioner for federal goment.

Chief Obafemi become di Vice President of di Executive Council during di civil war.

Awolowo na im lead di opposition Action Group party for Federal Parliament.

Although im no win di race for di presidency of Nigeria for second republic, Chief Awolowo na di second most popular candidate afta Alhaji Shehu Shagari.

Awolowo photo dey for ₦100 naira note for Nigeria currency.

5. Funmilayo Ransom Kuti (25 October 1900 - 13 April 1978)

Funmilayo Ransom Kuti na di only woman on di list of Nigerian independence fighters.

Fumilayo na school teacher, politician, an activist for women rights and she also be traditional ruler.

She be Fela Kuti mama di famous Nigerian singer.

Funmilayo na di first woman to drive car for Nigeria.

Dem elect her to di council of traditional rulers, wia she be representative of di Yoruba community.

Her struggle cause her children to suffer, especially during di military regimes.

6. Sir Ahmadu Bello, Governor of Sokoto (June 12, 1910 - January 15, 1966)

Dem born Sir Ahmadu Bello for Rabbah town inside Sokoto state for northern Nigeria.

Sardauna na one of di most famous Nigerian leaders.

Ahmadu Bello hold di throne of Sardaun of Sokoto and lead di Northern Pipo Congress, NPC, wia im dominate di kontri politics for di First Republic.

Sir Ahmadu Bello fight to seek freedom for Nigeria, afta im returned from im trip to di UK, im collect appointment as a member of parliament representing Sokoto province.

Di photo of Sardauna dey for ₦200 naira note one of Nigerian currency.

Some of di memorials to Sardauna na Ahmadu Bello University in Zaria wey dem name afta am sake of di role im role im play for di development of di north of di kontri.

7. Tafawa Balewa (December 1912 - 15 January 1966)

Alhaji Sir Abubakar Tafawa Balewa na di first Prime Minister of Nigeria afta di kontri gain independence for 1960.

Dem elect Sir Abubakar Balewa as a Member of Parliament for di Northern Province for 1946, bifor im go to di Federal Parliament for 1947.

Tafawa Balewa become a member of parliament wey work in favor of protecting di north of Nigeria.

Alhaji Abubakar Tafawa Balewa together wit Sardaunan Sakwato form di Northern Pipo Congress (NPC).

Source: BBC