Serious kasala burst for Gambia afta di Auditor-General reject Adama Barrow appointment
Serious kasala burst for Gambia afta di Auditor-General Modou Ceesay bin reject President Adama Barrow appointment and security officers bin block am make e no enta im office.
Ceesay bin reject di appointment to become Minister of Trade, Industry, Regional Integration and Employment for Gambia.
President Barrow bin make changes to im cabinet for 10 September 2025, wia e announce different appointments.
For im cabinet changes, Gambia president bin appoint anoda Auditor General for di kontri, and dis announcement don cause kasala and tok-tok within Gambian citizens.
Videos wey dey go viral for social media show wia security officers bin dey guide Auditor General Ceesay comot from im office.
Pipo gada to see how di Auditor General dey comot from office, while e dey cooperate wit di securiti officers.
Di National Audit Office for Gambia confam di incident say security officers no allow make dia Auditor General enta office based on instruction.
"Di National Audit Office confam di presence of security officers from di Kairaba Police Station for dia its premises today, led by one Commissioner Jawo.
"Di officers inform di Office say dem dey instructed to stop di Auditor General from entering di premises until further notice."
According to di Audit Office, Auditor General Ceesay bin agree to return home, cooperate and tell staff make dem avoid any fight wit di officers.
"Di officers don collect im office key and lock am," di Audit commit say.
Why di Auditor General reject di appointment
According to Auditor General Ceesay statement for 14 September, e say dem no tell am about di appointment bifor dem send am letter.
E add say im no accept di appointment.
"Upon receiving di letter of appointment on 10 September 2025, I quickly reject di offer di same day and formalized my decline through my letter wey dey dated 11 September 2025."
Di Auditor General say e dey committed to im constitutional duties and e go dey transparent for anytin wey im do.
Meanwhile, Gambia govment say President Barrow bin act in accordance wit sections 71 (1) and 71(3) of dia Constitution.
Some of di pipo wey bin dey affected na Baboucar Ousmaila Joof wey dem move from Minister of Trade, Industry, Regional Integration and Employment to di Ministry of Defence.
Modou Ceesay, Auditor General to Minister of Trade, Industry, Regional Integration and Employment.
Den, Cherno Amadou Sowe wey be Director of Internal Audit as Auditor General while Masireh Drammeh go be acting director of Internal Audit.
Ceesay become Auditor General of di National Audit Office (NAO) of di Gambia afta im appointment for November 2022.
Bifor dem appoint am as Auditor General, e serve as di Chief Executive of di Internal Audit Directorate under di Ministry of Finance and Economic Affairs for Gambia.
Serious tension dey between di Auditor General and President Barrow govment.
Since 2022, di finance ministry neva approve Ceesay audit reports since as President Barrow dismiss di reports as just opinions.
As Auditor General, Ceesay dey oversee public financial accountability and e dey enjoy security of tenure.
Dem only fit comot am for office if e dey unable to perform im functions sake of sickness, misbehaviour, or incompetence.
Afta di securiti officers bin no allow am enta office, di youths for Gambia don dey show diasef say dem go full streets if dem no release di Auditor General.
#Media Release pic.twitter.com/m4GJDMtbPb
— National Audit Office, The Gambia (@NAOGambia) September 14, 2025