Menu

Some Africans dem born for France dey japa back to Africa to search for a future

Screenshot 2024 10 28 175444.png Menka Gomis leave im friends and family for France

Mon, 28 Oct 2024 Source: BBC

Na for France dem born Menka Gomis but im don decide say im future dey for Senegal, wia im parents from come.

Di 39 years old na part of di many French Africans wey dey comot France, blaming di increase in racism, discrimination and nationalism.

BBC Africa Eye don torchlight dis situation – wey dem dey refer to as "silent exodus" - to find out why pipo like Gomis no dey satisfied wit life got France.

Gomis set up one small travel agency wey dey offer packages, mainly to Africa, for pipo wey wan reconnect wit dia ancestral roots, and now im get office for Senegal.

"Dem born me for France. I grow up for France, and we know some kain realities. Racism plenty. I bin dey six and dem call me di N-word for school. Every day," Gomis, wey go school for southern port city of Marseille, tell BBC World Service.

"I fit be French, but I also come from elsewhere."

Gomis mama move go France wen she be baby and no fit understand wetin dey ginger am to leave im family and friends to go Senegal.

"I no just dey leave for dis African dream," im explain, come add say na mixture of responsibility wey im feel towards im parents homeland and also opportunity.

"Africa na like Americas at di time of… gold rush. I tink na di continent of di future. Na wia e still get everytin to build, everytin wey remain to develop."

Di link between France and Senegal – wey be mainly Muslim country and former French colony, wey be one of di former main location for di transatlantic slave trade - dey long and complex.

One recent BBC Africa Eye investigation meet migrants for Senegal wey ready to risk dia life for dangerous sea crossing to enta Europe.

Many of dem dey end up for France wia, according to French Office for Protection of Refugee and Stateless Persons (OFPRA), many of dem look for asylum a record number of times last year.

Around 142,500 pipo na im apply, and na about one third of all requests for protection dem accept.

E no clear how many dey choose to do reverse journey back to Africa as French law forbid gathering data on race, religion and ethnicity.

But research dey suggest say highly qualified French citizens from Muslim backgrounds, mostly di children of immigrants, dey quietly leave.

Di ones wey we meet tell us say attitudes towards immigration dey become harder for France.

Since dia appointment last month, Prime Minister Michel Barnier and Interior Minister Bruno Retailleau don pledge say dem go crack down on immigration, both legal and illegal, by pushing for changes to law domestically and for European level.

Fanta Guirassy don live for France all her life and she dey run her own nursing practice for Villemomble – one village outside Paris - but she dey also plan to move to Senegal, wia dem born her mama.

"Unfortunately, for some few years now for France, we don dey feel less and less safe. Na shame to tok am, but dat na di reality," di 34-year-old tell BBC.

"Being a single mother and having a15-year-old teenager mean say you always get dis small fear for your stomach. You always dey dey afraid."

Her wake-up call happun wen police recently stop and search her son as im and im friends dey gist for street.

"As a mother, e dey quite traumatic. You see wetin dey happun for TV and you see am dey happun to oda pipo."

For June last year, riots happun across France afta police shoot and kill one 17 years old Nahel Merzouk - im be French national wit Algeria parents.

Di case still dey under investigation, but di riot shake di kontri and reflect di anger wey dey hide for pipo mind for years sake of how dem dey treat ethnic minorities for France.

One recent survey of black pipo for France suggest say 91% of pipo wey dem question be victims of racial discrimination.

Afta di riots, UN High Commissioner for Human Rights (OHCHR) call on France to address "issues of racial discrimination wey dey im law enforcement agencies".

French foreign ministry dismiss di criticism, say: "Any accusation of systemic racism or discrimination by police for France dey totally groundless. France and im police fight strongly against racism and all forms of discrimination."

However, according to French interior ministry statistics, racist crimes rise by one third last year, wit more dan 15,000 record of crimes based on race, religion or ethnicity.

For schoolteacher Audrey Monzemba, wey im parent na Congolese, dis kain change for society don "become very anxiety-provoking".

Early one morning, we join her as she dey waka through one multicultural and working-class community outside Paris.

Wit her young daughter, she dey move by bus and train, but as she near di school wia she dey work, she remove her headscarf wit style under di hood of her coat.

In secular France, wearing hijab don become very big controversial issue and 20 years ago dem ban am for all state schools – dis na part of di reason way make Monzemba wan leave France as she dey look to move to Senegal wia she get connections.

"I no dey say France no be for me. I just dey say wetin I want na to fit succeed for environment wey respect my faith and my values. I wan fit go work witout removing my veil," di 35-year-old tok.

One recent survey of more dan 1,000 French Muslims wey don comot France to settle abroad suggest say di trend dey grow.

Dis dey happun as Islamophobia enta anoda level afta di 2015 attacks wen Islamist gunmen kill 130 pipo for different locations Paris.

Moral panic around di separation of goment and religion and job discrimination "dey di heart of dis silent getaway", Olivier Esteves, one of di authors of di report France, You Love It But You Leave It, tell BBC.

"Ultimately, pipo moving from France constitute real brain-drain, as na mainly highly educated French Muslims wey dey decide to leave," im tok.

Take Fatoumata Sylla, 34, wey her parents come from Senegal, as example.

"Wen my papa leave Africa come here, im bin dey look for better quality of life for im family for Africa. Im dey always tell us: 'No forget wia you come from.'"

Di tourism software developer, wey dey move go Senegal next month, say by going to set up business for West Africa, she dey show say she no forget her heritage - though her brother Abdoul, wey dem also born for Paris, no dey convinced.

"I dey worry about her. I hope she go do OK, but I no feel di need to reconnect wit anything," im tell BBC.

"My culture and my family dey here. Africa na continent of our ancestors. But no be really ours becos we no dey dia.

"I no tink say you go find some ancestral culture, or one imaginary Wakanda," im say, referring to di technologically advanced society for Black Panther movies and comic books.

For Dakar, we meet Salamata Konte, wey establish di travel agency wit Gomis, to find out wetin dey wait for French Africans like her wey dey choose to settle for Senegal.

Konte exchange one high-paying bank job for Paris for di Senegalese capital.

"Wen I land Senegal three years ago I bin shock to hear pipo call me 'Frenchie'," di 35-year-old say.

"I say to myself: 'OK, yes, indeed, dem born me for France, but I be Senegalese like you.' So at first, we bin get dis feeling wia we say to ourselves: 'Damn, dem reject me for France, and now I come here and dem also reject me here.'"

But her advice be: "You have to come here wit humility and dat na wetin I do."

As for her experience as businesswoman, she say e bin dey "really difficult".

"I often tell pipo say Senegalese men dey misogynistic - anti-feminist. Dem no dey like to hear dat, but I tink say na true.

"Dem dey find am hard to accept say woman fit be CEO of company, say woman fit sometimes give 'orders' to some pipo, dat I, as woman, fit tell driver wey late: 'No, e no normal for you to come late.'

"I tink we need to prove ourselves a little more."

Even so, Gomis dey excited as im await im Senegalese citizenship.

Di travel agency dey do well and in say im dey already work on im next venture - dating app for Senegal.

Source: BBC