Di popular DJ also bin dey run private security company wey dey offer services to VIPs
Police for South Africa dey chook eye into di fatal killing of one popular DJ, DJ Warras wey en real name be Warrick Stock.
According to SABC news, Gauteng police tok-tok pesin ask for information from di public to assist dia investigation.
E no dey clear wetin be di motive for di shooting wey happun for Johannesburg central business district but police say three attackers "bin ambush am wey dem open fire afta he park his car. Di suspects now run away on foot."
Gauteng Police tok-tok pesin Tinstwalo Sibeko add say "we no arrest anybody yet but we dey investigate dis case. Any pesin wey get information fit contact di police," SABC quote.
DJ Warras sister tok say di incident "dey traumatic but make pipo give us privacy to mourn. E leave behind beautiful children, we need positivity right now."
We sabi say DJ Warras speak about many tins and controversial topics – make we focus on wetin he stand for"
She confam say dem bin shoot her brother at di Carlton centre for Johannesburg.
Sources say DJ Warras don secure five protection orders bifor his murder. Dis protection orders be against pipo wey dey occupy di Zambezi building for di central business district.
E dey alleged say di 40-year-old DJ bin receive death threats bifor his murder on Tuesday.
Di sports minister also explain say he vex sake of DJ Warras be against hijacking of buildings.
"Illegal foreigners enta dis kontri and hijack buildings; and now dem kill one of our own. I dey wait for di police minister to tok us who kill am. But I fit bet my last money say ibi di illegal foreigners wey hijack our buildings wey don kill am," oga Gayton McKenzie tok.