Menu

South Africa politician Julius Malema appear for court for firearm case

J Malema.png Julius Malema appear for court to know im fate for alleged firearm case

Mon, 29 Sep 2025 Source: BBC

Di president of Economic Freedom Fighters and South Africa opposition leader Julius Malema appear for court to know in fate for alleged firearm case.

Di court proceeding dey take place for di East London Magistrate Court wia Malema dey appear ova di case wey don happun since 2018.

Di charges na say Malema act contrary to di Firearms Control Act and say e unlawfully dey in possession of firearms and ammunition wen di incident happun during EFF 5th Anniversary 2018 celebration.

Already, EFF Officials from both national , provincial and regional leadership dey in attendance for court to witnes di court proceedings.

EFF tok for dia X handle say 'we must neva dey discouraged; you must nevea dey tired becos victory dey certain.'

Dis incindet wey carry Malema and im bodyguard go court bin happun for July 2018 wen im party EFF dey do dia 5th birthday celebrations for Sisa Dukashe Stadium for Mdantsan, Eastern Cape, South Africa.

During di rally, dem say one video bin capture moment wey Malema bin allegedly fire gun near crowd.

Dem accuse di bodyguard say na im bin give Malema di weapon bifor di discharge am.

For one of im court appearance, Malema say e no dey guilty, e tok say di na fake firearm wey no get any live ammunition inside.

Malema appear for court and e don siddown for long hours as di judge dey read out all di evidences wey dem find and wetin witnesses tok.

Malema put hand for jaw dey listen to di judge as e dey look straight waiting for judgement as di judge read out di long papers.

Dis no be di first time wey Malema dey face serious kwanta.

For June 2025, di United Kingdom bin permanently deny di South Africa politician Malema entry into dia kontri.

UK Home Office tok say dem deem di controversial politician 'non-conducive to di public good', as dem cite both im character and association concerns.

Among di issues wey dem flag na Oga Malema public support for Hamas, one organization wey dey banned for UK under terrorism laws.

Dat na di second time in two months UK go deny di South Africa opposition leader entry into di kontri - but dem tell BBC say dis decision dey 'valid'.

Also for August 2025, Malema also enta gbege for di allegation of hate speech, wey carry am go court and di Equality Court for Western Cape Town bin find Malema guilty of hate speech afta di South Africa Human Rights Commission bin file against am.

Meanwhile, Malema party EFF, say dem dey go Supreme Court of Appeals to challenge di court decision say di speech wey Malema bin give for October 2020 na hate speech.

EFF for one statement wey dem post for dia personal X handle dat time say dem reject di court decision wey claim say, statements wey Malema make, na hate speech and e dey encourage violence.

Source: BBC