BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

South African actress Esta TerBlanche die at di age of 51

Screenshot 2024 07 22 113337.png Popular actress Esta TerBlanche

Sun, 21 Jul 2024 Source: BBC

Popular actress Esta TerBlanche wey dey known for her role in soap opera don die.

Terblanche wey dem born for 7 January 1973 bin die for her residence and wetin cause di death still dey under investigation, according to di County of Los Angeles Medical Examiner.

Di South African actress bin die on Friday 19 July 2024 at around 11:10am for Los Angeles.

Di 51 year old actress dey well known for di different roles wey she play for soap operas and TV series wey pipo like to dey watch.

Esta TerBlanche don win di Miss Teen South Africa bifor and she do many oda tins for di movie and fashion industry.

Di Los Angeles Medical Examiner identify her as 'White/Caucasian female' and na Epperson Justine be di investigator wey dey in charge of her case.

Who be Esta TerBlanche

Di South African actress, Esta TerBlanche become popular for her role as Bienkie Naudé Hartman in South Africa drama, Egoli on M-Net (DStv 101) in 1992.

For 1991, TerBlanche win Miss Teen South Africa. Di young beauty queen decide to pursue her acting career as she feature for di TV series Egoli di following year, wia she continue to work until 1995.

For 1996, TerBlanche comot for South Africa to feature inside America soap operas, All My Children wia she play di role, Gillian Andrassy until 2001.

Afta she don spend 23 years for America entertainment industry, TerBlanche tok say she go like retire to return back to South Africa wia she open her own spa, explore her interest in documentaries wit South Africa filmmaker Michael Kastenbaum.

Di ogbonge actress marry Andre de Kock for young age bifor she divorce her ex-husband for 2008. She feature for several TV shows both in South Africa and America

Source: BBC