BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Timeline of military bomb and drone incidents for Nigeria wey kill civilians

54914649 Hoton alama

Wed, 6 Dec 2023 Source: BBC

Di Nigeria military drone incident wey kill civilians during one Maulud gathering for Tudun Biri village for Kaduna State, north-west Nigeria on 3 December 2023, no be di first wey go ever happun for Nigeria.

Records show similar incidents wey involve military bomb attack on civilians in recent years.

Dis incidents highlight instances wia military bombs or drones mistakenly target civilians.

Security experts wey don repeatedly condemn these attack on civilians, attribute am to errors or negligence for di kontri fight against insurgency.

Dis na compilation of some of di mistake drone attacks by di Nigerian military:

Yunusari - Yobe state, 15 September 2021

On 15 September 2021, more dan 10 civilians die for Buhari village for Yobe state, north-east Nigeria and 20 odas injure for inside one attack wey di Nigerian military aircraft carry out by mistake.

Di pipo of di town bin tell BBC at di time say dem wake up to see three warplanes dey fly for sky for dia town.

Den one of di planes burst into flames for anoda part of di town, pesin wey im relatives die for di incident tell BBC.

However, dat time, di tok-tok pesin for di Nigerian Air Force, Air Commodore Edward Gabkwet, bin deny say dia men fire any shot for one statement.

Raan - Borno state, 18 January 2017

For Borno state, north-east Nigeria, one Nigerian military plane mistakenly kill some refugees and aid workers for Raan village on 18 January, 2017.

Di Nigerian Army tok say di warplane attack di pipo on di assumption say dem be members of di Boko Haram group. At least 70 pipo die for di attack.

Doma - Nasarawa state, 27 January 27 2023

Similar incident occur for Doma, Nasarawa state, north-central Nigeria. Di Nigerian army bin release bomb wey kill at least 28 civilians on Wednesday, 27 January, 2023.

Di incident happun afta some herdsmen carry dia cattle from Benue state go anoda location.

Di PR Nigeria newspaper bin report say di military bin earlier don receive informate say some suspected terrorists don penetrate one area wey share border wit Nasarawa and Benue state.

Sake of dat, di military bin arrange one special operation to fight di terrorists, na during di operation dem mistakenly attack herdsmen wey go bail dia cattle for Benue state.

Police for di state bin confam say dem bury 28 pipo from di attack.

Kwatar Daban Masara - Borno State, 28 September 2021

Many civilians bin die sake of warplanes attacks on ISWAP fighters for Lake Chad area, for Kutar Daban Masara village on 28 September, 2021.

Di AFP news agency bin report at di time say at least 20 fishermen die, but for inside oda intelligence reports wey BBC see, di Air Force bin claim say na only one fisherman die and six odas injure.

But some reports tok say na 50 to 60 pipo die for di attack.

Nigerian security forces don dey fight ISWAP for 12 years now.

ISWAP bin dey always attack di Nigerian Army dat time.

Mainok - Borno State, 25 April 2021

Di Nigerian Air Force bin carry out one attack for Mainok town, wey dey 55 kilometers from Maiduguri wey lead to di death of several pipo.

Although di authorities no tok di exact number of casualties, however, security sources inform BBC say approximately 30 sojas lost dia lives during di attack.

During di incident, reports show say IS fighters for West Africa bin target di soja base for Borno State, wey prompt response from di Nigerian Air Force to help di embattled troops.

Di Air Force at di time, bin confam say dem dey investigate fotos and videos wey dey circulate about di incident.

Mutumji - Zamfara State,19 December 2022

For Zamfara state, north-west Nigeria, at least 64 pipo die for one deadly Nigerian army drone attack for Mutumji village, Maru local government for di state.

Residents of di area bin tell tori pipo say most of di pipo wey die na insurgents, but many civilians including children also die for di attack and 12 pipo injure.

Dem confam say di airstrikes wey dem launch for three neighbouring villages bin force di terrorists to run go di nearest town of Mutumji hide.

Nigeria goment bin issue one statement for 21 December, wey shed more light on di attack and dem describe di attack as unfortunate.

Kunkuman Bayan Dutse - Katsina State 7 July 7 2022

Similarly, for Kastina state, at least one civilian die and 14 pipo injure for one attack wey di Nigerian military warplane carry out against bandits for Safana local government area of di state.

Pipo for di village bin claim say na Nigerian military plane wey dey find bandits bomb dia town, but di army bin counter dis claims, dem tok say dia forces kill only 24 terrorists for di assault on di area.

Nacahade - Republic of Niger 20 February 2022

For di Maradi region for di Republic of Niger, the Nigerian army mistakenly caise di death of seven children and injure five odas for inside one airstrike for di area, according to wetin di region govnor tell French news agency.

Govnor Chaibou Aboubacar bin explain say di airstrikes, wey di Nigerian army carry out lead to di death of children.

Di govnor tok say im belief say di Nigerian army mistakenly target di children as dem dey try engage bandits for di border areas.

E also report at di time say 12 children dey involved for di incident, wit seven fatalities and five sustain injuries.

Di unfortunate attack bin occur as di children dey play, and dia parents bin dey jolly one holiday.

Source: BBC