BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Tins to know about Cholera wey don kill 30 pipo for Nigeria and how to avoid am

Screenshot 2024 06 19 113126.png Cholera don kill 15 pipo for Lagos, Nigeria commercial capital

Mon, 17 Jun 2024 Source: BBC

Cholera don kill 30 pipo for Nigeria according to informate from Nigeria centre for disease control.

Di infection wey dey spread through contaminated food or water dey cause diarrhoea and severe dehydration.

NCDC say di disease don spread to 30 out of di 36 states for di kontri and affect 96 local goment areas.

Lagos State, di kontri commercial capital record 15 deaths and 17 confirmed cases, plus 350 suspected cases of di diseases.

Di places wia dis disease neva reach for Nigeria dey veri few.

For Nigeria, cholera na common and seasonal disease, wey dey occur evri year mostly during di rainy season for areas wit poor sanitation.

Tori be say di first series of cholera outbreaks for Nigeria happun between 1970 and 1990.

Major epidemics also occur for 1992, 1995-1996, and 1997.

Between January and October 2010, di federal ministry of health bin report 37,289 cases and 1,434 deaths.

While for 2011 na total of 22,797 cases of cholera wit 728 deaths and case-fatality rate of 3.2% dem bin record .

NCDC also bin record 42,466 suspected cases including 830 deaths from 20 out of di 36 states from di beginning of 2018 to October 2018.

Dis na wetin you suppose know about Cholera wey go help you avoid am:

Cholera symptoms

According to di National Health Service (NHS) for UK, below na di symptoms of cholera:

*Watery poo wey go make you go toilet well-well

*Feeling sick or you dey sick

*Belle pain

*dehydration

How to avoid cholera

Dis na tins you fit do to help you to avoid to fall sick if you dey travel to areas wia cholera dey:

*Wash your hands wit soap and water regularly, especially afta you go toilet and before you prepare food or eat

*Only drink bottled water or tap water wey dem boil

*Brush your teeth wit bottled or boiled water

Tins you no suppose do

*No eat uncooked fruit and vegetables (including salads) wey you no wash wit bottled or boiled water and prepare yourself

*No eat seafood

*No use ice for your drinks

Vaccination for cholera

Vaccine dey for cholera, but most pipo no need am.

Di vaccine dem dey give as a drink. For adults, 2 doses (dem give dem 1 to 6 weeks apart)

E fit provide protection for up to 2 years.

Treatment for cholera

Di main treatment for cholera na to drink plenty of fluids, including rehydration solution.

Di rehydration solution na powder wey you go mix wit water to replace salts, sugars and minerals wey your body don lose through diarrhoea. Usually e dey available from pharmacies.

If you dey very sick, you go need take treatment for hospital wia dem go teat you wit

Source: BBC