BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Tinubu New Year 2023 message to Nigerians

87874150 Nigeria President Bola Ahmed Tinubu

Mon, 1 Jan 2024 Source: BBC

Nigeria President Bola Tinubu don wish kontri pipo Happy New Year for inside one early mor-mor national broadcast on Monday.

For di national broadcast, e also highlight im journey as president so far.

"Though di past year na a very challenging one, e dey eventful in so many ways. For our kontri, na a transition year wey see a peaceful, orderly and successful transfer of power from one administration to anoda, marking yet anoda remarkable step in our 24 years of unbroken democracy." E tok.

Everything I don do in office, every decision I don take and every trip I make outside di shores of our land, since I assume office on 29 May 2023, I do am in di best interest of our kontri." E tok.

Di president commit to making Nigeria, destiny of choice for local and foreign investment as e promise say im administration go work diligently to make sure say every Nigerian feel di impact of dia goment.

"I take oath to serve una, and I go give my best at all times."

E also extend a call to political opponents in di last 2023 presidential elections to come togeda and work with am for di betterment of di kontri.

Some of di key points from di broadcast na wetin di president tok on fuel subisdy, di foreign exchange system, security, steady power, food supply and affordability, fiscal and tax policy reforms and implementation of a new minimum wage for workers.

On Fuel Subsidy removal and Forex mata

Di president touch on di issue of di fuel subsidy removal and changes to di foreign exchange system.

"Over di past seven months of our administration, I don take some difficult and yet necessary decisions to save our kontri from fiscal catastrophe. One of dem na decision to remove fuel subsidy wey bin don become an unsustainable financial burden on our kontri for more dan four decades.

Anoda na di removal of di chokehold of few people on our foreign exchange system wey benefit only di rich and di most powerful among us."

Di president agree say e know say di two decisions bring some discomfort to individuals, families and businesses but say di rough times no go last.

We dey update dis tori.

Source: BBC