BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Tributes pour in for Zanele Mbokazi, ogbonge South African wey die

Screenshot 2024 08 12 145553.png Ogbonge personality for South Africa Zanele Mbokazi

Mon, 12 Aug 2024 Source: BBC

Ogbonge personality for South Africa Zanele Mbokazi don die.

Mbokazi na di founder of popular reality award event, Crown Gospel Music Awards for South Africa wia she celebrate music stars wey dey do well.

She also be radio presenter for South Africa based Ukhozi FM and her death don trouble many of her konti pipo.

Di tori of her news enta social media on Monday 12 August, 2024 wen her husband announce her death.

Bishop Mpendulo Nkambule post di tori of her death for im Instagram page wia e say make pipo give di family some privacy.

"Na wit a heavy heart na im we di Nkambule and Mbokazi family announce di passing of our dearly beloved Ms Zanele Mbokazi-Nkambule, founder of Crown Gospel Music Awards & UKhozi FM radio personality," her husband announce.

Di husband add say di late personality ‘depart go be wit di Lord for di early hours of 12 August 2024, for Parklands Hospital and dem dey grateful for all di support wey dem receive throughout her illness.’

Mbozaki fight cancer till she die

Before her death, Mbozaki bin fight cancer attack wey land her for hospital.

For May 2024, di late Mbozaki bin post for her social media account say her friends dey for di corner of her hospital ward as she dey battle di pain of her illness.

“For di middle of pain, confusion and anxiety, friends don beautify every corner of my ward,” she write.

She bin don already say she hate cancer and she no get plan B until di illness bow to her.

Late Mbozaki Husband also praise her say she dey strong as she dey battle di illness.

She pass away just eight days to dia anniversary.

Bifor her death, friends and families bin dey organise evening prayer for her for Johannesburg to recover from her condition and she return home for May 22, 2024.

Tributes for Zanele Mbokazi

Democratic Alliance (DA) wey be di second-largest political party for South Africa don send condolence messages to di family of Mbokazi.

Di party say di voice and leadership influence of di late Mbokazi go dey "deeply missed by many."

Bifor her death, her Crown Gospel Music Awards just open nomination for dis year awards ceremony wey go close for 30 September.

View this post on Instagram

A post shared by Bishop Mpendulo Brian Nkambule (@bishopmpendulonkambule)







Source: BBC