Menu

Trump claim say di deal to buy TikTok don complete - Who be di owner and how e go work?

US President Trump.png Trump sign executive order wey approve US-China TikTok deal

Fri, 26 Sep 2025 Source: BBC

President Donald Trump say deal to find new owner for social media app TikTok for di US don dey ground and e get China president Xi Jinping blessing.

Trump sign executive order on Thursday wey declare say di deal wey im plan meet legal requirements wey bin call for di banning of di app for US unless dem sell am to di Chinese parent company ByteDance.

For comments for Oval Office, him and vice president JD Vance say group of investors go buy TikTok operations for US to create new company value wey reach 14 billion dollars (£10.5 billion).

ByteDance and Chinese authorities neva confirm di deal.

Why US wan ban TikTok?

For years US officials and lawmakers argue say di kain links wey dey between ByteDance and Chinese govment dey threaten national security.

Many bin dey fear say Beijing fit force ByteDance to give dem data of dia US users wey reach about 170 million.

TikTok and ByteDance bin reject dat criticism, but similar concerns don make dem collect ban and restrictions for oda kontris around di world.

For April 2024, US Congress pass bill - wey former President Joe Biden sign into law, di law give ByteDance nine months to find US approved buyer or dem go shutdown TikTok.

TikTok call di law unconstitutional and claim say if US censor dia users, e go get strong impact on free speech. E bin launch plenti legal challenges wey no work.

ByteDance insist say dem no get plan to sell.

Afta Trump take over for January, e extend di initial deadline to allow make dem search for new owner for di app. Di president don push back dat deadline several times to make sure say dem get enof time to complete di deal.

Wetin be di TikTok deal and how e go work?

Di TikTok deal wey Trump dey pursue go get US investors to take over operations of di app for di kontri.

On Thursday, Trump say dem go release list of sophisticated investors, e mention some pipo wey go dey involved: Tech giants Oracle and chairman of di board Larry Ellison, wey be close Trump ally; Rupert Murdoch from Fox Corporation; Michael Dell, wey be head of Dell Technologies.

Di investors go control di algorithm wey go power di US version of TikTok, and Americans go hold six of di seven seats for di board of directors wey go oversee am.

According to di executive order wey Trump sign, China go own less dan 20 percent of di new joint venture.

Di algorithm na di technology wey dey determine wetin users fit see for dia feeds, dem dey see am as di most valuable and controversial part of di app.

Under di new deal, American TikTok go use new algorithm wey go dey based on di existing version, but dem retrain am wit US user data, according to di White House.

"Trusted security partners go monitor di software updates, algorithms and data flows, according to di executive order.

Oracle don already dey store TikTok America user data on dia Server wey dey for US, as part of existing agreement and so e go continue.

Trump and Vance say dis arrangements meet di requirements for sale of TikTok wey dey inside di 2024 law, and e go ensure say di social media app go kontinu dia operations for di US.

White House don also identify private equity firm Silver Lake as anoda investor. E get stake for di City Football Group, wey own Manchester City football club.

Plenti public figures like OnlyFans founder Tim Stokely, star YouTuber Jimmy Donaldson - AKA Mr Breast follow for pipo dem bin sample as potential partners.

Wetin TikTok and ByteDance don tok about di deal?

ByteDance and TikTok neva comment on di deal publicly.

But for statement earlier for September, ByteDance thank Xi and Trump "for dia efforts to preserve TikTok for di United States,"

Wetin China tok about di TikTok deal?

President Trump tok say na di Chinese President XI Jinping approve am via call wey dem make on September 19.

Trump day e tell am to proceed wit di deal say "China dey on board."

But Beijing dey dey careful in di matter dan Washington.

"Di Chinese govment dey respect di wishes of di enterprise, and dey welcome am to carry out commercial negotiations in accordance wit market rules wey go reach conclusions wey dey compliant wit di laws and regulations of China, and to strike balance of interests," na so dem tok afta di Trump announcement.

Analysts say believe e dey extremely unlikely say TikTok go sale dia prized app without blessing from Beijing.

Di Chinese govment dey expected to issue export license for di TikTok algorithm soon.

Trump say im go discuss di deal wit Xi Jinping for di Asia-Pacific Economic Cooperation Summit for South Korea for end of October.

Wetin di deal mean to US TikTok users?

According to TikTok, dia users dey spend average of 51 minutes per day on di app for 2024.

Wen dem announce di bill, plenti pipo wey dey earn dia living on di app tell BBC say di loss go dey devastating.

For March 2024, TikTok tell dia users to reach out to dia political representatives to make complain. Some lawmakers say di lobbying campaign don actually reinforce dia concerns about di app.

Experts say oda video sharing apps like Instagram Reels, YouTube Shorts and anoda Chinese app RedNote go benefit if dem ban TikTok.

But even if dem secure di future of di app for US, assurance no dey say dia users go stick to di new version of di app.

"Di jury dey ask weda di new US-only app go be di true replica of di old one, wit powerful algorithm and experience," na so Kelsey Chickering tok. Im from market research company Forrester.

Source: BBC