Menu

Trump dey host five African leaders - which kontris dey di list

Donald Trump  DKbQoDW9 US President Donald Trump

Thu, 3 Jul 2025 Source: BBC

President of di United States Donald Trump go host five leaders from African nations for Washington next week.

According to White House official wey tok on Wednesday, e say di discussion wit Trump na to tok 'commercial opportunities'.

Dis dey come afta Trump bin don sama different African kontris wit tariffs.

Some of di African kontris wey Trump sama wit tariffs early dis year also dey among dose wey e go host next week 9 July, 2025.

According to Reuters, Trump go host di five kontris for a summit from 9 - 11 July and dia focus go be on commercial benefits.

Di White House official tok say di reason why Trump dey host di African leaders na for opportunities wey go benefit America and oda African partners.

Also aleast 25 African kontris dey face partial and total US travel bans inside one new anti-immigration measure by US President Trump administration.

According to one internal State Department memo wey Reuters see, America goment dey extend dia travel restrictions on 36 more kontris, wey go potentially ban citizens of these kontris entry into di US.

Some of di African nations wey e invite come di US dey among dose wey dey face di travel ban.

"President Trump believe say African kontris dey offer ogbonge commercial opportunities wey dey benefit both di American pipo and our African partners," di official tok.

Meanwhile, Trump administration don cut several foreign aids to Africa including di USAID. Di US president say di spending cut na wetin e consider as wasteful and e no align wit im policy.

Di five kontris wey Trump go host

Di five kontris wey Trump go host for America na:

.Gabon

Gabon, dey on di west coast of Africa and don get few leaders since dia independence from France for 1960, wit Omar Bongo ruling as president for more dan four decades until e die for 2009.

Gabon na major oil producer but a third of dia population dey live for poverty, according to di World Bank. Dia population na around 2.3 million.

Dem comot Ali Bongo for a coup for August 2023.

Gabon military leader Gen Brice Oligui Nguema wey bin lead di 2023 coup wey end almost 60 years dynasty bin win di April presidential election wit more dan 90% of di votes, provisional results show.

.Guinea-Bissau

West Africa Guinea-Bissau na part part of di Portuguese Empire for centuries, but di kontri don become one of di poorest for di world.

Guinea-Bissau get cashew nut crop wey dey provide a modest living for most of dia farmers, and dis na di main source of foreign exchange.

Wit population of about 2.1 million, today Guinea-Bissau get massive foreign debt and dia economy dey rely heavily on foreign aid.

Mr Umaro Sissoco Embaló na di president afta e win di December 2019 presidential election.

Liberia

Liberia na Africa oldest republic, but dem sabi am for 1990s during di long-running, civil wars and dia role for a fight for neighbouring kontri Sierra Leone.

Although e dey founded by freed American and Caribbean slaves, Liberia dey mostly inhabited by indigenous Africans, wit di slaves' descendants comprising 5% of di population.

Life expectancy for Liberia na 59 years for men and 62 years for women. Dem get population of about 5.3 million.

Di opposition leader Joseph Boakai bin defeat di incumbent George Weah for di November 2023 presidential election run-off—to become di incumbent leader.

.Mauritania

Mauritania na one of Africa newest oil producers. E dey known as di Islamic Republic of Mauritania wey be di bridge between di Arab Maghreb and western sub-Saharan Africa.

Na a largely-desert country wey get cultural contrast, wit an Arab-Berber population to di north and black Africans to di south.

Many of di pipo for Mauritania na nomads. Dem get a population of about 4.6 million wit life expectancy of 62 years for men and 66 years for women.

Former defence minister Mohamed Ould Ghazouani na im be dia head of state afta di June 2024 elections wey e win comfortably for di first round witout a run-off.

Senegal

Senegal dey considered as one of Africa model democracies, as dis west African nation get a tradition of stable govments and civilian rule.

Wit population of about 17.1 million, Senegal dey live on agriculture.

For February 2024, President Macky Sall throw di kontri into a crisis wen e bin postpone di presidential elections.

However, dem do an election for March 2024 wia opposition politician Bassirou Diomaye Faye win di poll to become Africa youngest elected president.

Source: BBC