America President Donald Trump tok say Israel and Hamas don gree to di part one of im Gaza peace deal.
Dis agreement mean say dem go fit release Israeli hostages and Palestinian prisoners and comot Israeli forces as well and also allow aid to enta Gaza.
Israeli goment go meet around 2pm Jerusalem time wey be 12pm BST and if dem formally gree for di deal, e go mean say ceasefire don start be dat.
Di US tok say dem go release all do remaining Israeli hostages by Monday. But even though Hamas don confam di deal, Palestinian source tell di BBC say dem neva carry eye see di final list of prisoners wey Israel dey plan to release for dia hostages.
Meanwhile, Palestinians for Gaza abd hostage families for Israel don dey jolly dis informate as e dey drop.
And even Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu say di agreement na "great day" for im kontri and UK PM Keir Starmer say na "time of beta relief wey di world go feel".
While di first phase of dis ceasefire deal neva finish to comot officially, some tins dey wey we fit gist you wey dey di deal.
One Palestinian source don tell BBC say di deal tok say 250 Palestine prisoners and 1,700 Gazans wey Israeli forces arrest since di war start go dey released.
One Senior Palestinian official tell di BBC say from inside di deal, Israel go allow 400 aid trucks to dey enta Gaza per day, and di amount of aid trucks go dey increase as di stages dey go on.
White House official add say Hamas go also release di 20 living hostages dem get for id first phase too. But dis no be di be all and end all of di mata.
BBC Chief international tori pesin, Lyse Doucet tok say na just di beginning as dis first phase na cease fire, no be di main peace deal while BBC tori pesin for di Middle East Hugo Bachega say important details still dey to tok about.
How di deal go look like for ground?
Already di Israel Defense Force (IDF) don say dem don "start operational preparations bifor di agreement start to dey work".
E say, "part of dis process, preparations and combat protocol don dey happun to move go di adjusted deployment lines soon".
Dis na bicos of say if di Israeli goment approve di deal later on Thursday, e go mean immediate ceasefire wey mean say Israeli troops must move back to agreed line.
More expectation dey of wetin go happun for di next three working days.
On Thursday, Israeli govment go vote on di plan and if dem approve am, di Israeli troops go start dey comot to agreed upon line.
Den Israel go start to dey allow 400 aid trucks to enta Gaza daily for id enxt five days according to wetin senior Palestinian official tell BBC.
One Friday, one senior White House official wey follow BBC US partner CBS News tok, say e go take less than 24 hours for Israeli army to move back finish, den afta dat one don finish, dem go give Hamas 72 hours to release di hostages wey dem get for Gaza.
By Monday na wen US dey expect say di release of hostages go start but dem say Hamas fit run am early.
Trump say e fit enta Middle East on Wednesday as dem go finalise di deal later dis week. E say e expect to dey dia as dem dey release di hostages.
'We don survive dis kasala' - Reactions on di deal
For Gaza, many pipo including di ones wey dia pipo don die dey celebrate dis phase one for peace.
One doctor wey dem dey call Mousa for central Gaza tok say, "we don loose plenti tins for dis two years of war. Di Gaza Strip dey destroyed. Hard times still dey wait us for front o, but di important tin be say we hope we go dey safe".
Meanwhile pne pharmacist Suhar Shaath use shock tok say, "up until now I no believe say dis war go end and I go still dey alive. We survive di Kasal".
For di oda side of di divide, Israelis dey jolly di news too. Mama of one of di hostages, Matan Zangauker, Einav write for X say, "Matan dey come home to me, to im sisters Natali and Shani and to Ilana, di love of im life".
Even pipo wey loose dia loved ones wey dem carry as hostages say dem happy for di ones wey dey come home.
Israeli Prime Minister Netanyahu don tok say, "wit God help we go bring dem (the hostages) home."
UK Prime Minister Keir Starmer dey hope say, na "sustainable path to long term peace"
Trump write for Truth Social say, "dis na ogbonge day for di Arab and Muslim world, Israel and di kontris wey surround am, and di United States of America and we tank mediators for Qatar, Egypt and Turkey wey work wit us for dis ogbonge and historic event to happu. Blessed are di peace makers".
Meanwhile UN humanitarian oga, Tom Fletcher post for X say UN workers need safe access as dem don readi to "save lives" even as e call di mata "great news. Make we comot di hostages and make aid enta fast".
