BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Turkey earthquake: Hundreds die for south-east Turkey as ogbonge quake hit near di Syrian border

Pipo for Lebanon and Cyprus also feel di earthquake

Mon, 6 Feb 2023 Source: BBC

One update fro di Syrian health ministry say 237 don die for di kontri - across di provinces of Aleppo, Latakia, Hama and Tartus.

More dan 600 pipo dey injured, di ministry tok.

More dan 100 pipo don die and many odas still dey trapped afta one powerful earthquake hit one wide area for south-eastern Turkey, near di Syrian border.

Di US Geological Survey say di 7.8 magnitude tremor strike at 04:17 local time (01:17 GMT) at a depth of 17.9km (11 miles) near di city of Gaziantep.

For Turkey, officials bin confam more more dan 76 deaths and 10 cities wey dey affected, including Diyarbakir.

Pipo dey fear say di death toll fit rise sharply for di coming hours.

Many buildings don collapse and dem don send rescue teams to search for survivors under huge piles of rubble.

Turkish Interior Minister Suleymon Soylu say 10 cities dey affected: Gaziantep, Kahramanmaras, Hatay, Osmaniye, Adiyaman, Malatya, Sanliurfa, Adana, Diyarbakir and Kilis.

One BBC Turkish correspondent for Diyarbakir, report say one shopping mall for di city don collapse.

For Syria, state media report many deaths for di regions of Aleppo, Hama and Latakia.

Source: BBC