BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

UEFA Champions League Final: Borussia Dortmund and Real Madrid go battle for di trophy

Borussia Dortmund And Real Madrid Finals.jpeg Borussia Dortmund meet Real Madrid for finals

Sat, 1 Jun 2024 Source: BBC

Real Madrid and Borussia Dortmund dey go head to head for di UEFA Champions League final wey go hold for Wembley Stadium on Saturday 1 June.

Dis go be di most important match for European club football as di two clubs go battle for di ultimate prize.

Dortmund really surprise plenty pipo for dis season competition as dem beat strong teams like PSV, Atletico de Madrid and Paris Saint-Germain to reach di Wembley final.

Madrid also fight plenty battles for dia knockout stages to reach di final. Dem bin meet wit Leipzig, Manchester City and Bayern before dem reach dia 18th final for dis competition.

Dis na di first time wey Real Madrid, 14-time record winners of di competition go reach Champions League final without losing a match.

Dortmund bin finish for di fifth position for German Bundesliga dis season and dem only don lift di Champions League once.

Madrid don claim a record extending 33rd LaLiga title last month while dem also break record of 14 times Champions League winner.

Real Madrid boss Carlo Ancelotti tok say im players go feel di “fear” of di Champions League final wen dem face Borussia Dortmund for Wembley.

"Champions League final na di most important game and di most dangerous one," Ancelotti tok.

“You go need to dey lucky, play well and never lower your guard but wen you reach final success, you go begin worry.”

Meanwhile, Dortmund midfielder Julian Brandt tok say im side understand di task wey dey for hand.

"Dem be di ultimate opponent, nothing big pass dem for di Champions League, wit dia success and dia history," Brandt tok.

Team news

Belgium international Thibaut Courtois go follow play for dis match and dat na real boost for Real Madrid.

Di Belgium international don play only four times dis season and e neva feature for di Champions League.

Im stand-in during dat period, Andriy Lunin, bin miss di flight to London sake of flu but e dey expected to link up wit di squad before di game. David Alaba dey absent sake of injury while fellow defender Eder Militao dey struggle to prove im fitness afta long layoff.

Dortmund, also dey head into di contest in a similar mood to 1997, wen dem also be huge underdogs before dem beat Juventus 3-1 for di final for Munich.

Head coach Edin Terzic say: "We happy to dey here, but we dey here to win.

"You don't come here to play a final, you come here to win it. We wan hold dat trophy for our hands."

Sebastien Haller na Dortmund only doubt as di Ivorian striker dey struggle to regain full fitness afta one ankle problem.

Julien Duranville and Ramy Bensebaini are both definitely out.

Predicted line-ups

Dortmund:

Kobel, Ryerson, Hummels, Schlotterbeck, Maatsen, Can, Sabitzer, Adeyemi, Brandt, Sancho, Fullkrug

Suspended: None

Real Madrid: Courtois, Carvajal, Nacho, Rudiger, Mendy, Valverde, Kroos, Camavinga, Bellingham, Rodrygo, Vinicius Junior

Suspended: None

Source: BBC