Menu

Uganda sentence ex-rebel to 40-year jail term for ogbonge landmark case

Screenshot 2024 10 25 123936.png Authorities find Thomas Kwoyelo guilty of 44 charges

Fri, 25 Oct 2024 Source: BBC

One Ugandan court don sentence a former commander for di notorious Lord's Resistance Army (LRA) to 40 years in prison afta one ogbonge landmark war crimes trial.

Authorities find Thomas Kwoyelo guilty of 44 charges, including murder, rape, kidnapping and using violence to rob.

E bin deny all charges wey dem bring against am.

Kwoyelo na di first commander from di feared rebel group to dey convicted by a Ugandan court.

Di LRA wey dem found for di late 1980s, dey accused of carrying out atrocities in Uganda and neighbouring countries.

Dem do Kwoyelo trial for di city of Gulu for northern Uganda - di region wey dey terrorised by di LRA for more dan two decades.

One notorious incident na one attack on a camp for displaced civilians for Pagak for northern Uganda for 2004. Dem use wooden clubs to take beat some women and children to death.

Di International Crimes Division of di Ugandan High Court decide not to give Kwoyelo di death sentence or life imprisonment because LRA fighters bin kidnap am as a child and turn am into a soldier.

Di group dey known for kidnapping children and turning dem into child soldiers or sex slaves.

Kwoyelo say e be12 years old wen dem kidnap am.

Di court also say Kwoyelo bin show say e dey sorry and dem see am as say e no longer pose a threat to society.

Joseph Kony form LRA for Uganda more dan two decades ago, and claim to be fighting to install a government based on di Bible 10 Commandments.

Di group bin dey notorious for cutting off pipo hands and legs. Hundreds of thousands of pipo bin dey forced out of dia homes by di fightng.

LRA bin dey operate mostly for northern Uganda at first, den dem shift to di Democratic Republic of Congo wia dem arrest Mr Kwoyelo for 2009, and later di Central African Republic.

Di group don dey mostly wiped out. One international effort to capture Kony fail and dem later suspend am after dem see am say e no longer pose a danger to Uganda.

Kwoyelo originally bin get 78 charges against him - dem free am of three murder charges and 31 oda charges bin dey dismissed.

Di former commander go serve a total of 25 years in jail as e don already spen 15 years on remand.

Im lawyers say dem intend to appeal against each conviction and di court don give dem 14 days to do so.

Di court go hear di case on reparations for Kwoyelo victims separately.

Di International Criminal Court for di Netherlands sentenced anoda LRA commander, Dominic Ongwen, to 25 years in prison, for 2021.

Like Kwoyelo case, Ongwen escape life sentence on di consideration say dem kidnap am as a child and e dey groomed by rebels wey kill im parents.

Source: BBC