Menu

Uganda torchlight death of Nigerian footballer wey die for shopping mall

Screenshot 2025 02 25 144031.png Lawal helped Vipers win the league and cup double in 2023

Tue, 25 Feb 2025 Source: BBC

Police for Uganda dey investigate di death of one Nigerian professional footballer wey allegedly fall from one shopping for capital Kampala.

29 years old Abubakar Lawal fall from third floor balcony for Voicemall Shopping Arcade wia e go to visit im Tanzanian friend.

Dem carry am go hospital wia dem pronounce am dead, na so police tok.

Dem tok say Lawal friend Omary Naima bin leave am for her room wey be part of di mall building - and dey prepare tea before di incident happen.

Lawal na striker for local team Vipers Sports Club. Dem don express sadness over di "untimely passing of our beloved player".

Tributes don dey pour in for di footballer, wey don dey wit Vipers since 2022 afta e do two years play for Kigali Rwanda. For 2023 e help Vipers win di league and cup double.

Di club say "Lawal (man from Sokoto) na unique pesin. E get big heart of gold. E care about pipo and dey go out of im ways to help pipo. E dey incredibly generous".

"We mourn di sudden death of our ex-player Abubakar Lawal earlier today. Make God grant am eternal rest," na wetin im former Nigeria team Nasarawa United tok.

"E dey had to take say you Lawal no dey again. You dey kind, talented, jolly and loving person na him you be. We go miss you forever bro," na wetin Ugandan footballer Mustafa Kizza write.

Local tori pipo say di matter don bring up more questions dan answers as plenty tori dey fly unto how di player take die.

Some tori pipo bin report say e die via motorcycle accident. Police say di exact circumstances of im death dey under investigation.

"Authorities dey retrieve CCTV footage and dey conduct thorough interrogation to establish di exact circumstances wey surround di incident." Na so police tok.

Police don retrieve some items wey belong to di deceased player including two smart phones, shoes, headsets and training kit.

"Further updates go show later as di investigation dey progress," na so police add.

Source: BBC