Menu

'Under dis condition we no go play' – Super Eagles shun Libya match afta disturbing 13 hours

Screenshot 2024 10 14 164604.png Super Eagles of Nigeria don stay for almost fifteen hours for Abraq Airport for Libya.

Mon, 14 Oct 2024 Source: BBC

Players and officials of di Super Eagles of Nigeria don stay for almost fifteen hours for Abraq Airport for Libya.

Dis na afta di Libyan authorities force dia flight to land for Abraq Airport instead of di Benghazi airport wia dem bin dey scheduled to land, according to di Nigeria Football Federation.

Di two kontris go meet again on Tuesday for di second leg of dia Africa Cup of Nation qualifiers - di first leg bin end for a narrow one nil win for Nigeria.

Videos and fotos wey NFF release for social media show as di Super Eagles players sidon for di airport in groups dey gist afta di more dan 12 hours flight from Nigeria to Libya.

Authorities say di team gatz travel anoda three to four hours by road from Abraq to Banghazi wia di match suppose hold.

Di Libya football federation also bin complain of how Nigeria authorities bin keep dem for hours wen dem land for di kontri for di first leg encounter.

E neva clear if dis na revenge or normal logistics problem.

Source: BBC