BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Victor Osimhen fit become di next big name to miss out on prize?

Victor Osimhen, Achraf Hakimi da Mohamed Salah

Fri, 8 Dec 2023 Source: BBC

Pipo dey see Nigeria striker Victor Osimhen as di player wey get di best chance to win di African Footballer of di Year on Monday.

But di Napoli striker go face competition from Liverpool forward Mohamed Salah and Paris St-Germain defender Achraf Hakimi.

Egypt captain Salah bin win di Confederation of African Football (Caf) award for 2017 and 2018 - and also be runner-up to Sadio Mane for 2019 and 2022 - while right-back Hakimi play important role for Morocco historic run to di semi-finals for di 2022 Fifa World Cup.

Osimhen na di highest-ranked African player for di 2023 Men's Ballon d'Or vote, im finish eighth afta e score 26 goals last season to help Napoli win dia first Serie A title in 33 years.

But, if dem overlook am, di 24-year-old go join a long list of ogbonge players wey no win di biggest individual prize on di continent.

BBC Sport Africa profiles some of di oda big names from across di continent wey missed out on di Caf award.

Jay-Jay Okocha (Nigeria)

Pipo bim see Jay-Jay Okocha as one of di best dribblers for di history of di game, Super Eagles midfield maestro Okocha made the Caf shortlist three times.

Im be part of di ogbonge golden generation of Nigeria wey win di 1994 Africa Cup of Nations (Afcon) and di gold medal for di 1996 Olympic Games wey beat Brazil and Argentina.

Okocha brightest moment na for di1998 World Cup for France, wen im shine wit im dribbling skills as Nigeria comot for di round of 16, but im narrowly miss out to Mustapha Hadji of Morocco for di Caf awards dat year by just two points.

Dem name am again for di shortlist in 2003 and 2004 but in finish third on both occasions.

Na Samuel Eto'o of Cameroon win di prize even though Okocha finish as joint top scorer and man of di competition for di 2004 Afcon.

Meanwhile, former Chelsea midfielder John Obi Mikel take second place for 2013 while ex-Everton striker Daniel Amokachi make di podium in both 1995 and 1996.

Michael Essien (Ghana)

Anoda ogbonge midfielder from West Africa, na Michael Essien wey sabi hustle and control ball for di middle.

Im also sabi score extra-ordinary goals from long-range.

Essien bin win back-to-back French titles wit Lyon and dem bin name am Ligue 1 player of di year in 2005 before im join Chelsea for an-African record fee of £24.4 million dat time.

Di Ghana international become a key man for di Blues over di course of almost one decade for Stamford Bridge.

E help di west London club win two Premier League titles, four FA Cups and di Champions League in 2012.

Dem shortlist am for di Caf award evri year from 2005 to 2009, and im finish second behind Mali striker Frederic Kanoute in 2007.

Ghana all-time leading goalscorer Asamoah Gyan na anoda notable name to miss out.

Im finish behind Eto'o in 2010, while Bayern Munich and Black Stars centre-back Samuel Kuffour be second in both 1999 and 2001.

Mohamed Aboutrika (Egypt)

No football kontri for Africa bin fit stop Egypt between 2006 and 2010, dem lift di Afcon trophy three times, back to back to back.

And one of di players wey bin dey do di work for di tall-conquering Pharaohs side na Aboutrika.

Im be attacking midfielder wey dey shook eye for goal, e dey put body well well for im kontri and for club side Al Ahly, wia im win five African Champions League and four Caf Super Cup titles.

Aboutrika win Caf inter-club player of di year award four times, dem also name am for Caf team of di year four times and dem select am too for di Afcon Dream Team two times.

Maybe im decision to stay for im home kontri throughout im career affect im chances of winning di major Caf award.

Di closest finish na second-place behind Emmanuel Adebayor in 2008.

Egypt striker Hossam Hassan bin also miss out over di course of im two-decade career wey make am win three Afcon titles and finish as top scorer in di 1998 tournament.

Benni McCarthy (South Africa)

Joint top scorer for di 1998 Afcon wit seven goals (alongside Hassan) and a Champions League winner wit Porto in 2004, McCarthy na one of Africa's most potent strikers of im generation.

Im partnership up front wit Shaun Bartlett make Bafana Bafana one of di big sides for di continent.

Im play for di World Cup in 1998 and 2002.

However, McCarthy miss out on di selection for di South Africa squads wey win di 1996 Afcon on home soil and host di 2010 World Cup.

Wit all di plenti trophies im win for im career for di Netherlands and Portugal, McCarthy no make di shortlist for di Caf award.

Elsewhere in southern Africa, dem bye-pass Christopher Katongo in 2012 afta im captain Zambia to a shock Afcon triumph - yet di forward manage console imsef wit di 2012 BBC African Footballer of di Year, e win wit more dan 40% of public votes.

Seydou Keita (Mali)

Di midfielder na key part of Pep Guardiola dominant Barcelona side wey win three consecutive La Liga titles between 2009 and 2011.

E become di first Malian to represent di Catalan club afta e join from Sevilla in 2008.

Im win di Champions League, Uefa Super Cup and Club World Cup wit Barcelona in 2009 and 2011. Dem also include am for di Caf's team of di year.

Keita finish second behind Yaya Toure for di 2011 award, and him also help Mali to third-place finish for di 2012 and 2013 Afcon.

Kalidou Koulibaly na anoda West African wey miss out of di individual prize, dem no do di award for 2020 or 2021 sake of di coronavirus pandemic.

Now, as e dey wit Saudi Pro League side Al-Hilal, di centre-back captain Senegal to di Afcon title last year but im team mates Sadio Mane and Edouard Mendy na dem dey podium wit Salah instead.

Source: BBC