Joe Biden as im fall for stage
US President Joe Biden slip come fall as e dey hand out diplomas for one graduation ceremony for di US Air Force Academy for Colorado.
Dem help oga Biden, wey be di oldest serving president at 80, back up to im feet and e be like say e no injure.
Di president bin don dey stand for about an hour and a half to shake hands wit each of di 921 graduating cadets.
Di White House communications director bin tok earlier "e dey fine".
"Sandbag dey on stage as e dey shake hands," Ben LaBolt write on Twitter afta di Thursday fall.
"I got sandbagged," di smiling president bin joke about am wit tori pipo as e land White House for evening.

President Joe Biden falls on stage at the Air Force Graduation ???????? pic.twitter.com/XYQFjsM33l
— Daily Loud (@DailyLoud) June 1, 2023
White House press secretary Karine Jean-Pierre say oga Biden dey feel "totally fine" and e flash "a big smile" as e board di plane.
Critics don tok say oga Biden dey too old to run for a second term as president.
Recent polls suggest say a majority of US voters dey concerned about im advanced age. E go be 82 at di start of a second term if e win.
Dis fall, in addition to previous stumbles from im bicycle and on di way up di Air Force One stairs, fit add to those concerns.
“I got sandbagged”
— Benny Johnson (@bennyjohnson) June 1, 2023
pic.twitter.com/9WWqUrU6xf
"I hope e no dey hurt," oga Trump, wey be 76-year-old wey dey often yab oga Biden age tok. "Dat no dey inspiring."
"You gatz dey careful about dat because you don't - you no want dat. Even if you gatz tip toe down di ramp," oga Trump add, e of course dey refer wen e carefully waka comot one stage wey make headlines for 2020.
Florida Governor Ron DeSantis, anoda 2024 contender for di Republican nomination, don also react to di fall during aone campaign event for New Hampshire:
"We hope and wish Joe Biden a swift recovery from any injuries e fit don sustain.
"But we also wish di United States of America a swift recovery from di injuries e don sustain because of Joe Biden and im policies."
President Biden dey fit
President Biden last physical examination happun for February.
White House physician Dr Kevin O'Connor bin write at di time: "Di President remain fit for duty, and e dey fully execute all of im responsibilities without any exemptions or accommodations."
Dr O'Connor bin add say oga Biden dey walk wit "stiffened gait", wey di wear and tear on im spine and nerve damage for im feet largely cause, but dat im condition no from a previous physical for November 2021.
Oga Biden no be di first commander-in-chief to trip in front of di cameras.
President Barack Obama bin trip as e dey waka up di stairs for one 2012 event, while President Gerald Ford bin fall down di stairs of Air Force One for 1975.