BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Why pipo dey drag Drake like small gen after album release

Drakebeard 4 Drake use im collabo album with 21 Savage take beef plenti pipo sha

Sat, 5 Nov 2022 Source: BBC

Drake don become di subject of online dragging following di release of im new album wey im call Her Loss. Di album na collaborative album wey Drake do with 21 Savage. Dis go be dia second collabo. For di album e follow use rhymes and tori to drag plenti pipo in di process. Among dem na Megan Thee Stallion and Serena Williams billionaire husband, Alexis Ohanian. 'Lie bout getting shots, but she still a stallion' US Rapper Megan Thee Stallion do beta clap back on top Drake head afta e make dis statement from one of di songs from di album wey im call Circo Loco. She catch di sub for di song wia im bin rap say "lie 'bout getting shots, but she still a stallion". Di 'Her' rapper hala for social media say "since wen e don dey okay to joke about women wey dem shoot". She further accuse Drake say e dey use am to chase clout, say "I no say I dey very popular but stop to dey put my name for weak conspiracy theories for bars". Oda pipo for social media don make di mata begin to trend for social media

Drake has some of the biggest power and influence in the industry. He is playing a very nasty, harmful, and misogynistic game but Megan will come out on the other side.— Cece (@theeciarasnow) November 4, 2022

If corny was a car, Drake would be the hood ornament.— Michael J. Pagán (@MikeJPagan) November 4, 2022

Drake is clearly jealous of Megan thee Stallion. She’s hot, tall, naturally built in an athletic/built way. She’s a wordsmith. She also has the love of women. She’s literally everything that Drake can’t have. He’s pressed and it’s pathetic. He can’t be THE hottie.— ???????????????????? ???????????? ???? (@TheCourtKim) November 4, 2022 Megan Thee Stallion bin comot for 2020 to accuse anoda Canadian rapper Tory Lanez say e shoot am for leg afta one Hollywood party wey Kylie Jenner host. Di case dey go court from next week as oga Tory don already dey house arrest since last week. Pipo for twitter hey claim say Drake dey diss di famours rapper account off events as lies. Serena Williams 'Groupie' For wetin many pipo dey call di best song of di album, Middle of the Ocean, Drake say "Sidebar, Serena, your husband is a groupie". Groupie na wetin dem dey call fans of celebrities wey dey follow dem up and down, in hopes say di celeb go knack dem. But Alexis Ohahian no fit di mould seeing as im marry di ogbonge former tennis star for 2017, and dem get one daughter togeda. However di Reddit Found sub Drake back on twitter as im sef call imself "di best groupie for my wife and daughter" Why Drake no clear why im put Serena name for di album, around di time di tennis star meet her husband for 2015, tori bin comot say di rapper bin dey date am. Although none of dem comot ot confam di tori. For di same Circo Loco song wia im beef, Megan Thee Stallion, Drake come for di rapper formerly known as Kanye West too. Shey you remember for 2021, wen Drake and Ye do concert togeda to quash dia long term beef, well Drake say no be because of Kanye west im do am. E tok for di song say, "Linking with di opps, I did that for J. Prince". J. Prince na di founder of Rap-A-Lot wey bin ginger di rappers to squash dia beef. But contrary to normal Ye behaviour, e no come for di Canadian born rapper, for one tweet, di former presidential candidate, call for rappers to dey on one side, and end di tweet say, "Love Drake". Di last time di two collabo before di Larry Hoover concert na for 2016 before plenti gbas gbos enta di mata. Dis two grown men don use words take beef demselves like mad on top Twitter. E reach di top level during di 2018 beef between Pusha T wia Pusha reveal say Drake born pikin with one former porn star. Drake say na Kanye West tell Pusha as na im produce di song but Ye deny di claim. Ye just comot from one kasala wey cause many pipo to cancel am including brands wey bin dey collabo with him wey crash im net worth from billionaire to millionaire. Who be Drake? Drake wey dey call imself Champagne Papi na ogbonge rapper wey enta into di spotlight worldwide with Lil Wayne, Young Money entertainment. Before den Drake wey im real name na Aubrey Graham bin act for one TV show wey dem call Degrassi for Canada. So far Drake don break plenti records in cluding Billboard most wins in one year for 2017, as im gbab 13 awards. E don also get plenti worldwide hits including One Dance wey e feature Nigerian Star Wizkid. Drake dey different from most of di rappers wey e follow come from on top say e dey follow sing as well as rap for im songs with songs like "Better Find your loving". With gbedu from Hotline Bling, God's Plan and In My Feeling, Drake don stamp im name as ogbonga pesin for di hip hop game.

Source: BBC