Menu

WAEC obey court order as dem release all 2024 WASSCE results

WAEC Exams Students In A Hall Di West African Examinations Council (WAEC) don officially release all di results for 2024

Mon, 3 Mar 2025 Source: BBC

Di West African Examinations Council (WAEC) don officially release all di results from di 2024 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) wey dem bin hold.

Dem bin hold ova 10,000 results sake of suspected malpractices.

Di release of di results on Friday dey come afta di National Union of Ghana Students (NUGS) bin drag Waec to court and also threaten nationwide protest if dem no release di results.

Di head of Waec public affairs John Kapi tell tori pipo Citi FM say outstanding results no dey as dem don release evritin.

"As we bin promise, we keep to our word. By di close of 28th February, we bin don upload all di results of candidates wey we bin hold dia results. Di court bin order us to release dose results, and we don duly comply. So as far as dose examinations dey concerned, outstanding results no dey," e tok.

Oga Kapi say Waec bin anticipate say candidates go soon dey reach out for dis new week wit queries or complaints.

E say di results wey dem release accurately reflect di performance of candidates for di examination.

Waec officials dey mark candidates scripts?

No be Waec dey mark students examination paper, na examiners dem dey appoint to mark di scripts.

So who be dis examiners?

Dis examiners na sabi pipo for di education sector wey know classroom work well-well.

To ensure say mago-mago no dey for di grading system, Waec dey set up Committee of experts wey go come up wit di marking guide.

Na dem go drill all di appointed examiners well-well on all aspects of di marking scheme for one marking exercise wey dem dey call co-ordination.

Even wen di actual marking start, dem no dey leave di examiners on dia own.

Dem dey organise dem into small groups, each of dem go dey supervised by one highly experienced examiner wey be di Team Leader.

Na di Team Leader dey check and vet di group members marking progressively to make sure say dem dey follow di guidelines.

Di Team Leaders demsefs dey supervised by more experienced examiners wey dem dey call Chief Examiners.

Wen dem don mark finish, Waec go still employ anoda group of pipo wey dem dey call Checkers.

Di main role of Checkers na to make sure say all di marks wey di examiners give, dem record am correctly and dem transfer am to di right score sheets.

Waec no dey reveal di identity of di examiners wey dey mark di exam papers.

List of tins wey be exam malpractice for Waec

Candidates wey carry books or cribs enta examination hall na offense

To insult or assault any examination official na offense

To swap scripts inside examination hall na offense

To replace your answer scripts wit anoda one during or afta di examination na offense

Impersonation: Dis one mean say to write exam for pesin na offense

To take part in mass or organised cheating for exam hall na offense

Odas dey inside di Council Regulations & Syllabuses.

Source: BBC