President-Elect of di Republic of Ghana John Mahama go assume office as di sixth democratically elected President of di West Africa kontri afta di second term tenure of President Nana Akufo-Addo expire for 7 January, 2025.
Di Ghana electoral commission declare Mahama winner of di 2024 presidential election on Monday afta e beat oda presidential candidates wey contest for di 7 December election.
For im victory speech, Mahama say President Nana Akufo-Addo don follow am tok and dem don agree on early joint transition, wey go start on Wednesday 11 December.
Parliament go elect new speaker
Section 11 of di Transition Act tok say two days bifor dem go dissolve parliament (on di midnight of 7 January), di clerk gat to summon meeting wit di lawmakers wey don win dia parliamentary seats.
For dis meeting of parliament, dem go elect new speaker and deputy speaker, dem go take dia oath of office togeda wit di new parliamentarians.
Di speaker and di new parliamentarians go now take office on 7 January.
Swearing-in of di President
Na di Chief Justice of di kontri dey in charge to conduct di oath of office to di new president wia dis process go happun on 7 January 2025.
Usually di swearing-in-ceremony dey most likely happun for di kontri Independence Square. E neva dey clear wia dis one go hold.
In 2017, dem swear in president Nana Akufo-Addo for di Independence Square, wey be one of di kontri nationality monument.
However in 2021, dem swear in Akufo-Addo for di Forecourt of Parliament House upon di request of di lawmakers.
Di lawmakers don tok say di law dey provide say make dem swear in di president "in front of parliament" na so dem wan make dis happun inside Parliament House instead of oda places like di Independence Square.
E dey likely say John Mahama go kontinu dis way as dem go swear am in for di parliament Forecourt on 7 January 2025.
First 120-days in office
Di President-elect John Mahama don highlight 26 ogbonge tins wey im go do for im first 120 days in office.
E break am down into 14 days, 90 days and 120 days inside one policy document – Mahama's First 120 Days Social Contract wit di pipo of Ghana.
Di President-elect tok say for di first 14 days afta e assume power as di leader of di kontri, im go:
1. Nominate di complete list of cabinet ministers for parliamentary approval.
Within di first 90 - 120 days:
1. Put togeda di "Leanest and most efficient" goment under di fourth republic.
2. Establish robust code of conduct and standards for all goment officials.
3. Hold National Economic Dialogue to discuss di true state of di economy plus prepare homegrown fiscal consolidation programme to guide di budget.
4. Scrap E-levy taxes, Covid levy, 10% levy on bet winnings and Emissions levy to reduce di hardship wey kontri pipo dey face plus relax di high cost of doing business.
5. Review taxes and levies on vehicles and equipment wey dem dey import to di kontri for industrial and agricultural purposes.
6.Begin draft di needed legal amendments and prepare to implement di 24-Hour Economy Policy under di Office of di President.
7.Establish Accelerated Export Development Council (AEDC) to promote export to transform di economy.
8. Set up one national consultative conference on EDUCATION wey go agree on needed improvements to di sector. Implement di 'No-Academic-Fee' policy for all first-year students for public tertiary institutions—universities, colleges of education, nursing training institutions,
10. Introduce di following social interventions: Free tertiary education for pesins wit disabilities, di Ghana Medical Care Trust (MahamaCares) Fund.
11. Start di distribution of free sanitary pads to female students for primary and secondary schools.
12. Set up one goment policy wey go ban political appointees from purchasing state assets.
13. Allocate seed money for di establishment of di Women Development Bank.
14. Launch di following priority job creation programmes for di first budget: 'Adwumawura' Programme, 'National Apprenticeship Programme' and 'One Million Coders Programme'.
15. Set up inquiries and/or forensic audits into di following matters of public interest: Di collapse of Indigenous Ghanaian banks and financial institutions at a supposed cost of GHS25 billion, illegal printing of money, di US$58 million National Cathedral scandal, illegal and inflated single sourced contracts, COVID-19 expenditure scandal, PDS, Agyapa, SML, Ambulance spare parts deal, 13th African Games, Sky Train, Pwalugu Dam, Maths Sets, Galamsey Fraud, missing excavators and tricycles, Sputnik-V, BOST Scandal, and odas.
16. Begin review di Customs (Amendment) Act 2020 to scrap di law wey ban di importation of Tokunbo motors to rescue di local automotive industry.
17. Lay bifor parliament one new bill to streamline goment scholarship administration wey go ban political appointees from accessing goment scholarships plus eliminate political patronage, cronyism, nepotism, and corruption in awarding goment scholarships.
18. Ban illegal and new mining activities in forest reserves.
19. Launch 'The Black Star Experience' initiative as Ghana flagship Culture, Arts and Tourism brand to transform Ghana into tourism destination.
20. Commence investigative processes to purge state security agencies of all militia and vigilante elements.
21. Re-open investigations into major unresolved criminal cases wey include di 2020 election killings for Ayawaso West Wuogon by-election violence, murder of Ahmed Hussein-Suale and Silas Wulochamey.
22. Initiate investigation into di man-made disaster wey VRA spillage from di Akosombo and Kpong Dams wey displace and destroy di livelihoods of thousands of citizens for di Volta, Eastern, and Greater Accra.
23. Initiate immediate steps to compensate flood victims of pipo for Oti, Bono East and Savanna regions.
24. Carry out a shakeup of all loss-making SOEs and realign them to break even and transition into profit-making.
Di first coming of John Mahama in 2012
John Mahama first become president for di continuing term of office of im boss, Professor John Evans Atta-Mills afta im die on 24 July 2012 as im dey in office as president.
Later dat year, afta di presidential election, John Mahama win im first full election as presidential candidate of di national democratic congress.
Economy - No doubt say during di tenure of John Mahama as president in 2012, di economy get issues.
Prices of goods bin rise, inflation dey high wey many pipo dey unemployed.
One survey by di center for democratic development bin reveal at di time say 73% of Ghanaians don describe di economic situation between 2012 - 2016 as "very or fairly bad."
GDP growth bin dey around 4% at di time, wey goment bin borrow plenty moni, na so did opposition new patriotic party (NPP) at di time campaign wit to vote out di Mahama goment.
Infrastructure - Di NDC bin do plenti projects during dia tenure under John Mahama. Di goment build school blocks for senior high schools across di kontri to deal wit di issue of congestion and unavailability of schools for oda places.
Dem build di most ultramodern hospital (University of Ghana Medical Center), dem do roads, dem rebuild di terminal 3 airport, one ogbonge interchange for circle in Accra and oda tins.
But di opposition party while goment bin dey commission projects for di kontri, campaign say dis infrastructure neva go put food for dia table.
Corruption - During John Mahama im first term, many corruption cases bin dey. Some of im appointees and goment officials bin chop accuse say dem involve for corruption.
Di goment don pay one NDC financier $12.3m for one goment contract bifor di kontris Supreme Court order di businessman to pay di money back to di state.
Di opposition NPP use dis particular case to campaign against di goment wia dem lose power for di 2016 elections.
Oda corruption cases involve payment of $886,000 to di wife of one ogbonge party pesin to brand buses for di transport ministry. Afta many Ghanaians chook mouth for dis mata, di minister don resign wey dem force di company wey brand di buses to pay back di moni to di state and oda deals wia pipo tok say na corruption.
Power crisis - Under di John Mahama goment, power crisis don reach ogbonge levels. Many businesses don collapse, wia individuals bin suffer as some pipo lose dia jobs. Many families now buy generator sake of di power crisis wey di locals don dey call am "dumsor". But bifor di end of 2016, goment bin sign new agreements wey bring in more energy capacity to deal wit di problem.
John Mahama bin tok say im resolve di dumsor wahala bifor im lose di elections. Na so di NPP afta dem enta goment, don cancel some of dis agreements sake of dem tok say "e dey create excess capacity of power wia di kontri no dey need."
Years afta di NPP goment cancel some of dis contracts, di kontri don begin to dey face dumsor again, from 2023 until di 7 December elections in 2024.