One Federal High Court wey siddon for Abuja don grant bail to Deputy Commissioner of Police, Abba Kyari wey bin dey suspension since.
But wetin go happun to di 'Super cop' next neva clear.
Kyari bin dey detention since authorities arrest am for 2022 sake of wuru-wuru activities wey dem level against am.
Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) bin declare di former celebrated cop wanted over allegation say e get hand for one 25kg cocaine deal.
Authorities bin charge Kyari to court.
For di arraignment court, den order im remand for Kuje Prison, Abuja.
Wen di gebge burst, police bin set up one panel to probe di conduct of Abba Kyari wey be di former head of di Intelligence Response Team (IRT) of di Inspector General of Police.
Dem follow am up wit Kyari suspension from di force.
On Thursday 6 July 2023, Justice Kolawole Omotosho of di Federal High Court for Abuja grant am bail under very strong conditions.
Kyari still get criminal case to answer for front of Justice Emeka Nwite of anoda Federal high Court for Abuja.
Justice James Omotosho bin grant conditional bail to Abba Kyari for di sum of N50m wit two sureties in like sum.
Di court earlier for one ruling also grant bail to di oda defendants for di case.
"Dis deposition challenged by di complainant/respondent wey mean say dem admit. Dis show say di applicant no wan run away from im trial and don show willingness to attend court wen e require.
"Dis piece of fact go work in favour of di applicant, for dat, e be proof to court say di applicant no go jump bail if dem grant am same."
Di judge also add say di sureties must get property wey worth N25m within jurisdiction, among oda conditions.
E say Abba kyari and im sureties also need to deposit dia international passport, dia statement of accounts, di title deed of di sureties' property and recent passport photographs wit di Registrar of di court.
E don dey denied bail twice for di oda case wey dey pending bifo Justice Emeka Nwite, also of di Federal High Court, Abuja.
Further hearing for di case bifo Justice Omotosho don dey djourned till October 18.