Menu

'We no find any instrument of terrorism wen we arrest Kanu' - DSS witness

Nnamdi Kanu N.png Nnamdi Kanu

Fri, 2 May 2025 Source: BBC

One DSS witness for di ongoing terrorism trial of Nnamdi Kanu, tok say dem no find any instrument of terrorism on di Ipob leader wen dem arrest am in 2015.

Di witness, who give im name as Mr AAA, tok dis one as e dey undergo cross-examination by Kanu's lawyer, Kanu Agabi a senior advocate of Nigeria.

Mr AAA bin don give evidence on di last day of hearing on April 30, 2025, wia e narrate how dem arrest Nnamdi Kanu wit one woman for im hotel room in Golden Tulip Hotel for Lagos.

During di cross examination for court dis Friday, di defense counsel ask di witness weda dem find any instrument of terrorism on Kanu or di woman wit him wen dem arrest am. Di witness answered no.

Mr AAA admit say im bin analyze Nnamdi Kanu phone afta dem arrest am, but dem no make di report of di analysis available to di court bicos dem no think say e dey relevant to di trial.

Also during di cross-examination, Mr AAA say evidence dey wey link Nnamdi Kanu wit di insecurity for di south east region.

However, di defence counsel ask di witness weda di killings going on in Kaduna, Zamfara, Plateau and Benue States all dey related to agitation for separation, and e ansa no.

DSS making moves to extradite Simon Ekpa

Di witness also tok say e no dey aware of any oda pesin for Nigeria wey dey stand trial wit Kanu for terrorism sake of di Biafra agitation, but e know say one Simon Ekpa wey be known supporter of Nnamdi Kanu dey stand trial for Finland.

"I know say di service (DSS) dey on di process of extraditing him (Ekpa) to Nigeria to face charges," oga AAA tok.

E also tok say video evidence dey wia Nnamdi Kanu dey incite pipo do attack and damage goment facilities. However, wen Kanu lawyer ask am weda im or di DSS don eva catch one pesin wey destroy somebody property sake of order wey Kanu give am, di witness ansa "no".

Di trial judge, Justice James Omotosho adjourn di matter to May 6 , 7 and 8, 2025 for continuation.

Omotosho bin don promise say im go give di case accelerated hearing sake of how long e don dey linger for almost ten years.

Kanu, di leader of di indigenous People of Biafra (Ipob), a group wey dey agitate for di separation of di southeast region of Nigeria to bicom dia own independent kontri.

However, di Nigeria goment don declare di group as terrorist organisation.

Charges against Kanu

Count 1: Say you Nnamdi Kanu as member and leader of Ipob commit act of terrorism against di federal republic of Nigeria by making broadcast wit intention to intimidate di population.

Count 2: Say you Nnamdi Kanu as member and leader of Ipob commit act of terrorism against di federal republic of Nigeria by making broadcast wit intention to threaten members of di public wit sit at home order.

Count 3: Say you Nnamdi Kanu make broadcast wia you declare your sef as member and leader of Ipob, group wey Nigeria goment don ban.

Count 4: Say you Nnamdi Kanu make broadcast wia you encourage members of di public to kill Nigeria security officers.

Count 5: Say you Nnamdi Kanu make broadcast wia you encourage di public to attack officers of di Nigeria police force.

Count 6: Say you Nnamdi Kanu make broadcast wia you encourage members of di public to burn down evri federal goment facilty for Lagos wey lead to major economic loss to federal goment.

Count 7: Say you Nnamdi Kanu import Radio transmitter known as Tram 50L and hide am inside container for Ubulisiuzor for Ihiala Local government area of Anambra state.



Source: BBC