BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Wetin Arsenal midfielder Thomas Partey talk about comparisons wit Casemiro

Manchester United midfielder Casemiro and Arsenal midfielder Thomas Partey

Tue, 14 Mar 2023 Source: BBC

Arsenal Midfielder Thomas Partey for de first time comment on de comparison sports enthusiasts dey make between him den Manchester United midfielder, Casemiro.

Nicknamed de Octopus, Partey join Arsenal from Atletico Madrid in 2020 but within a short period establish himself as one of de best midfielders in de Premier League.

De comparison between he den Casemiro no dey go away, so beIN Sports throw de question about who be de best among dem.

“I make really happy say some people dey see me wey I think de most important thing be say I go continue to help my team which be de mentality I have and also dey work on myself.”

Mikel Arteta side dey hold crucial five point lead on top of de premiership, de Ghanaian international according to sports pundits be de ‘engine’ of de team.

Dem credit am as de one player who dey help give Arsenal de maximum points whenever he feature in games.



Partey vs Casemiro Stats

According to Compare FUT, both Casemiro and Thomas Partey be central midfielders in de Premier League.

Casemiro dey come from Brazil as Partey dey come from Ghana.

With total rating of 89, de higher player who dem rate higher between de two be Thomas Partyey while Casemiro get rating of 84.

In terms of dribbling, Partey de superior with 80, compared to 72 for Casemiro.

On football passing, Partey is get better score of 81, dis be higher pass de 75 for Casemiro.

When we look at pace, Partey get de advantage over Casemiro with 65, this be better pass 63 for Casemiro.

In terms if physicality for de two midfielders in FIFA 23, Casemiro be superior with 90, better than de 83 for Thomas Partey.

Also in terms of shooting, Casemiro dey slightly ahead with 73, while Partey get 71.

Also, Casemiro be better defender with 87 compared to Partey who get 83.

Who be Thomas Partey

Dem born Thomas Partey for Krobo Odumase on June 13, 1993.

He start dey play football for en local club Odometah's youth ranks.

He lef Ghana to Spain in search of opportunities wey he sign with Atlético Madrid in 2012 after brief period with Leganés.

Dem move Partey to de reserve but one year later Atletico call Partey into de main squad.

Partey make en first team debut for Atlético Madrid on 28 November 2015, replacing Luciano Vietto in a 1–0 home win against Espanyol.

He later solidify himself as a midfielder in de squad as he start dey score long range goals.

He win UEFA Europa League and UEFA Super Cup with Atletico Madrid in 2018.

He join Arsenal in 2020 on £45million deal.

Source: BBC