Menu

Wetin Defence HQ, Airforce tok about airstrike wey kill civilians for Zamfara

Screenshot 2025 01 13 153146.png Nigerian Air Force don confam say dem truly carry out airstrike attack for one village for Zamfara

Mon, 13 Jan 2025 Source: BBC

Di Nigerian Air Force don confam say dem truly carry out airstrike attack for one village for Zamfara state wit claims say dem target terrorist wey dem find for dat area.

Dis na afta tori come out say civilians dey among dose wey di air force strike hit and dem don die.

About 16 civilians na im tori tok say dem die from di attack- and e include local vigilantes for di community.

Dis latest airstrike na for Tungar Kara in Zurmi Local Government Area of Zamfara State and di Air force say dia main target for di operation na bandits.

Wetin di Air force come add be say dem dey concerned about di report say civilians die during di airstrike.

Dis no be di first time wey air strike go kill civilians wen Air force dey carry out dia operations for Northern Nigeria.

Director Public Relations and Information to di Air Force, Air Vice Marshal Olusola Fakinboyewa say dem wan start investigation to get di truth about di reports becos life of civilians get meaning to dem.

"Di Nigerian Air Force (NAF), for di recent airstrikes at Tungar Kara in Zurmi Local Government Area of Zamfara State, deal decisive blow to bandits terrorizing villages for di area."

"Howeva, while di operation bin successfully eliminate several bandits and lead to di recovery of some kidnap victims, di NAF view wit grave concern reports of di loss of civilian lives in di course of di operation.

Dis airstrike, according to report also claim lives of some local vigilantes wey dey for di area wia di airstrike happun.

"As a responsible and professional custodian of airpower for di security of di nation, di NAF get believe for di absolute value of di life of evri Nigerian."

Meanwhile, di All Progressives Congress (APC) for Zamfara state don send condolences to di civilians wey loss dia live for di strike.

Oda times wey accidental airstrike don happun

Sokoto Airstrike 2024

On 25 December 2024, tragedy for Rumtuwa and Gidan Sama for Silame local goment area for Sokoto State, northwest Nigeria wen military airstrike hit di village and kill pipo.

Dat Nigerian military airstrike kill 10 pipo and and injure six odas.

Sokoto State Govnor Ahmad Aliyu wey bin attend di burial of dos wey die for di attack say di "military carry out di attack by mistake" as e add say di "situation na fate, dis officials act in error, and dem do am to protect dis community."

To compensat dem, di govnor say e don deliver about 100 bags of food aid and about 20 million naira to di affected community.

'Na air force and ground force carry out di attack'

Silame local goment chairman Abubakar Muhammad tell BBC say na both air force and ground force carry out di attack as "di air force enter di area wit heavy tanks."

Meanwhile, Defence Headquarters (DHQ) bin blame wetin dem describe as a "secondary explosion" for di death of about 10 pipo afta airstrikes for Sokoto State, northwest Nigeria.

Kaduna state bombing 2023

Di Kaduna state goment tok say na Nigerian Army carry out di air strike for Tudun Biri village wey hit Tudun Birni for December 2023.

For statement, Samuel Aruwan wey be commissioner wey dey oversee ministry of internal affairs for Kaduna tok say Nigerian army don siddon wit deputy govnor Hadiza Balarabe to yarn say 'na mistake'.

Buwari village bombing 2021

Nigerian Air Force [NAF] bin admit for September 2021 say dia fighter jets kill civilians for Buwari village, Yobe state for Nigeria northeast.

NAF say di fighter jets kill 9 pipo and wunjure about 20 for Yobe State and na by mistake.

Air Commodore Edward Gabkwet, di tok tok pesin for Nigeria Airforce say dem regret wetin happun.

Port Harcourt helicopter strike 2021

One heavy strike bin hit cargo boat wey bin dey carry pipo and goods from Port Harcourt for River state to Bonny Island.

Meanwhile, Nigeria Defence Headquarters bin deny tori say di military fire di boat.

For statement from di Director Defence Information, Benjamin Olufemi Sawyerr sign, e explain dat time say di Air component of di Joint Task Force Operation Delta Safe (OPDS) bin get report from di ground troops wey bin dey do clearance operations say dem get resistance so dem send di combat helicopter to go support dem along Cawthorne Channel.

Eyewitness say pipo wunjure for di attack as bullet touch dem.



Source: BBC