BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Wetin Jamb tok about 2022/2023 cut-off mark

JAMB na di Di Joint Admissions and Matriculation Board of Nigeria

Mon, 26 Jun 2023 Source: BBC

Di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) don set 140 and above as cut off mark for 2022/23 admissions into universities for Nigeria.

Na Prof Ishaq Oloyede, Jamb Registrar tok dis one wen e dey address pipo for di 2023 Policy Meeting on Admissions to Tertiary Institutions and awards on Saturday for Abuja, Nigeria Federal capital Territory.

Prof Oloyede say di Board approve 100 as cut off mark into Polytechnics and Colleges of Education.

E explain say di figures wey im announce na di minimum score but say e no dey compulsory for di higher institutions to follow am.

Source: BBC
Related Articles: