Nigerian street pop musician Naira Marley
Nigerian street pop musician Naira Marley don clear di air ontop wetin e sabi about di death of im former signee, di musician wey dem dey call Mohbad.
Naira Marley wey im mama call am Abdulazeez Fashola tok dis one for almost two hours for video wey im post for im YouTube channel wey im call - My Side of Di Story.
Di musician bin dey accused say e get hand for di death of Mohbad wey im papa name am Aloba Oladimeji llerioluwa wey kpai for 2023.
For February 2025, Magistrate Court clear am and music promoter Sam Larry say dem no get hand for di death of di rising musician.
Naira Marley bin reveal among oda tins wia e bin dey wen e first hear di informate, im relationship wit Mohbad and also di relationship wit Mohbad family.
Even as all dis informate wey don comot about im case including di acquittal for Febuary, pipo no gree anytin say e no get hand.
Dis na due to video wia Mohbad allegedly tok say anytin wey do am make dem look Naira Marley and Sam Lerry side.
Anoda tin wey pipo dey torchlight be di way Mohbad comot Marlian Music for 2022 afta about two years wit di record label.
Na 7th of October 2022, na im Naira Marley tok say e get letter of termination from Mohbad lawyer.
'I no bully Mohbad, I no kill am' - Naira Marley
Naira Marley tok say e bin bring Mohbad as part of im brand for Decemeber 2019, wen e dey run im Marlian Fest show for Nigeria togeda wit CV Black and Zinolessky
For di video, Marley reveal di chats wey im bin get wit Mohbad and also reveal di first time e hear say di musician bn dey on drugs.
E say, "Dis be 7th of June 2020, di na wen I first hear say, Mohbad dey use sometin, dem say na Ice. Na di first time I hear say Mohbad dey use Ice but I no really knw wetin ice be."
E come find out say ice na anoda name for crack cocaine, and e even know pipo wey dey sell am say e even know wetin e don do pipo for di UK wey e dey come from.
"I no vex I just call to advice am and e tell me say, e bin start to de take am wit im crackhead friends. I sha advice am, no bad blood inside."
E use dis example to explain say e bin no dey tell im record label signees wetin dem go do, say, "I no dey force dem to do anytin".
Na Mohbad pick im own manager
Naira Marley tok say na Mohbda pick im own manager for imself.
E say, "dis dey very important, dis na for di 30th of July 2020, for ids chat you fit see say Mohbad pick im own manager by imself."
E say na bicos if you dey do your own music im no go pick your manager.
Di chat allegedly show Naira Marley dey tell Mohbad sometins wey dem wan run for im EP bifor di tok-tok move to manager.
Naira ask Mohbad, "abeg confam your manager for me again" and Mohbad reply say, "Tunde".
E say di only tin e chook mouth inside na di percentage na how much dem go pay di manager bicos Mohbad bin wan give am 25% but e tok say make dem give am 10%.
E also say di label get in house managers wey go guide di activities of di talent personal managers.
DIs point bin comot as important on top say for 2021, wen Mohbad bin disconnect wit Marlian Music, e also part ways wit im manager, get new one.
So, tok-tok come dey as to weda na Naira Marley bin pick im manager for am.
Howeva for 2022, Tunde and Mohbad start to dey fight about say Tunde no dey do di work ofbookingshows so e go book am imself.
Di fight heavy wella sotay e go physical but Naira Marley tok say "na record label terminal escape plan"
E tok say "di 4th of October, 2022, wit di fight between Mohbad and im manager, na di last time wey I don eva see Mohbad."
Mohbad dey fear hospital?
From di same Whatsapp chat thread, Naira Marley say Mohbad tell am say e don go hospital bifor.
E recall di chat wey Mohbad bin allegedly tok say e sick and e dey for hospital.
So di whole mata make Naira ask wit shock say, "Mohbad di fear hospital?"
Dat come up on top di auxillary nurse wey bin treat Mohbad just bifir e die, di tori from dat time be say e no dey like go hospital, na why e go meet dat nurse instead.
Wunmi mata and Money
Naira Marley reveal say dia contract bin dey very easy as e reveal say e dey pay for evritin while dem go share di proceeds 50/50.
But at first di account wey Mohbad dey give to collect im money no be im own and while Mohbad say na im mama account number, Naira Marley say e bin no like to dey send money go dia.
E reason say na bicos e tink say di account belong to Wunmi, Mohbad wife mama.
Later on, according to Naira, na so Wunmi call am say na im make Mohbad dey carry im money spend for women dem.
Howeva e say, "wit money me and Mohbad no get any wahala."
Howeva wen e comot Marlian music, Marley say e comot $72,000 from one account wey no be all im money be im own. So Naira Marley reveal say e hold im stream revenue till di money complete.
Mohbad mental health and health issues
"Nobodi wan make you die. If you die, notin go beta, e go just make evritin worse."
Naira Marley bin tell Mohbad dis one afta e bin dey alerted to Mohbad suicide attempt for 27 March, 2022.
E advice am say make e comot anytin wey dey stress am weda na im parents ooo, or even if na im wife, make e carry imself go relax wit Zino small.
E also cousel am say, "no be you make yourself, if you kpai now, na hell you dey go straight."
All dis one na on top di video wey Mohbad bin make in di last year say if anytin do am make dme hold Marlian music and Naira Marley responsible.
But Naira Marley later reveal say di video na sake of duress afta di NDLEA bin come pick up Zinolessky and odas.
"E bin dey for state of psychosis and for dat time e tok say Zinolessky na snitch and im no trust im wife", as we dey hear di video wey im play in Mohbad sound for di background wit woman as e dey cry.
Di mata bad sotay, Mohbad allegedly go show start to dey forget di lyrics to im own song. For di video Mohbad bin complain about pain and stress.
Naira Marley reveal say e bin spend a lot of money to dey run tests and get medicine for Mohbad wen e tok say e no dey feel imsef well.
E bin even say e follow Mohbad mama and papa tok on top di mata.
Mohbad Death
From di 4th of October wia Mohbad fight wit im former manager, Naira Marley say e no see di musician again even though pipo dey come tell am say, Mohbad one tok sorry.
But e say, "if I tink say e go die proably I go let am tok sorry but evritin bin dey alot".
When Mohbad die for Spetember, Naira Marley dey Amsterdam to go spend time wit im pikin dem and to shoot music video.
And na for dat outside di kontri waka, dem hear di news of Mohbad death
E say, "We go meet Zino for Montenegro, we go buy fried fish. We don buy di food, dem bring am na im someone for our group tok say Mohbad don kpai. I look am say na lie e wan blow again."
Na wen dem start to dey accuse am e see wetin kill Mohbad, na im im eye clear say e fit be true. But e also accuse bloggers say pesin pay dem to accuse im say na im kill dem.
E say, "I no even get chance to mourn am properly bicos dem dey blame me for im death."