BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Wetin President-elect Bola Tinubu tok as e land Nigeria from abroad

President-elect Bola Ahmed Tinubu as im return from Paris

Tue, 25 Apr 2023 Source: BBC

Nigeria President-elect Bola Ahmed Tinubu say im dey “extremely excited to be back home” afta im trip to Europe.

"I dey hale and hearty," Oga Tinubu tok contrary to speculations wey dey fly up and down say e dey seriously sick.

Oga Tinubu wey tok dis one for inside statement e post on im Twitter account add say im dey humbled by di warm welcome wey im receive as e land Abuja, Nigeria capital on Monday.

E add say di promise to deliver a kontri of renewed hope for all Nigerians still dey in motion.

Di former Lagos govnor wey officially comot Nigeria since March 22, return about one month before im inauguration on May 29, 2023.

E land di kontri wit im wife, Senator Oluremi; and di Vice-President-Elect, Kashim Shettima; Plateau State Governor, Simon Lalong; Speaker of di House of Representatives, Femi Gbajabiamila; dey among many oda high-ranking members of di party wey receive dem.



Oga Tinubu bin travel comot Nigeria afta di Independent National Electoral Commission (INEC) declare am as di winner of di 2023 Presidential election.

E win di election afta one tight race between im and di presidential candidates of di Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar and Labour Party flagbearer, Peter Obi.

Oda contenders for di kontri number one seat wey no dey happy wit di outcome of di election don carry di mata go di Election Tribunal.

Recently, Nigerians bin dey ask about di whereabout of di President-elect as e no show for public space for some weeks, wey make some pipo don dey reason say e bin travel out of Nigeria sake of im health.

Meanwhile, on 22 March, im media pesin, Tunde Rahman bin tok say oga Tinubu dey travel go abroad go rest sake of di stress e bin go through during di electioneering period and to also plain im transition programme ahead of im inauguration on 29 May. .

Oga Tunde say Tinubu go travel go Paris, Europe and Saudi for di Lesser Hajj.

“Di president-elect decide to take a break afta di campaign and election season wey dey serious to rest for Paris and London, preparatory to going to Saudi Arabia for Umrah (Lesser Hajj) and di Ramadan Fasting wey dey start Thursday,” e tok for statement.

Source: BBC