Menu

Wetin Ramaphosa tok about Limpopo accident wey kill forty-two pipo

Screenshot 2025 10 13 110356.png The passenger bus veered off the N1 highway and plunged down an embankment

Mon, 13 Oct 2025 Source: BBC

Forty-two pipo wey be Zimbabwean and Malawian nationals don die afta one bus wey dey carry dem go house turn ova for South African road.

According to wetin authorities tok, di bus bin run comot for di road as e dey drive along di mountain road.

Di accident crash happun for Sunday night 12 October 2025 wen di bus bin dey move through "mountainous section" of di N1 highway for South Africa Limpopo province, local transport officials tok.

Meanwhile, South African President Cyril Ramaphosa don mourn death toll wey e describe say e high.

Ramaphosa say di victims of di accident include seven children, as e describe am say no be only tragedy for di kontri but for "our sister states of Zimbabwe and Malawi" as well.

"On behalf of di govment and pipo of South Africa, President Cyril Ramaphosa offer im deep condolences to di nations of Zimbabwe and Malawi wey lose compatriots for di crash wey take place near Makhado, Limpopo, for Sunday, 12 October 2025," di South Africa govment statement tok.

Di cause of di accident still dey unknown but dem don launch investigation to find more about wetin cause am.

Although, di local transport officials say di bus bin "run off di road along sloopy mountain and e fall down for embankment," dem add.

According to reports, di bus bin dey travel from di city of Gqeberha for di Eastern Cape.

E neva clear clear how many pipo bin dey involved for di travel for di bus bifor e crash or how many pipo di bus bin get capacity to carry.

As well as di seven children, 18 women and 17 men bin die, while 49 pipo bin wunjure, according to wetin authorities confam.

Govment officials, including Transport Minister Barbara Creecy, dey set to visit di scene of di crash as well as di passengers wey wunjure.

Source: BBC