Menu

Wetin be CAPSAT and who be Colonel Michael Randrianirina, Madagascar new military leader

B.,bv,nm.png Madagascar crowd happy as military unit seize power

Thu, 16 Oct 2025 Source: BBC

One elite military unit tok say dem don seize power for Madagascar from President Andry Rajoelina, afta weeks of protest wey youths lead for di Indian Ocean Island.

For outside di presidential palace on Tuesday, 14 October, CAPSAT Chief Col Michael Randrianirina tok say di military go form govment and hold elections within two years.

E also announce say im don suspend key democratic institutions, except di lower house of parliament, wey earlier vote to impeach di president.

Dis include di senate, di constitutional court plus di electoral commission.

Gen Z protesters go dey part of di changes bicos "na for street dem take create di movement, so we get to respect dia demands", e add.

Wetin be CAPSAT? Di military unit wey dey known as CAPSAT na di most powerful for Madagascar.

Di unit bin support President Rajoelina wen e come into power for 2009, but dem join di protesters on Saturday. Dem turn di tide against Rajoelina di moment dem enta political arena on Saturday.

Dat na wen di sojas comot dia barracks, and join di youth-led protesters for di capital, Antananarivo, wey dey demand for di president resignation.

CAPSAT soldiers bin escort protesters on foot - and others drive inside di city, as crowds hang from dia vehicles.

Na Col Michael Randrianirina lead dis act of mutiny against President Rajoelina govment – di man wey dey for power for Madagascar now.

Madagascar constitutional court don name Col Randrianirina as di kontri new leader, even though one statement from di president office tok say im still dey in charge and e reject wetin e describe as "attempted coup d'etat".

CAPSAT stand for Personnel Administration and Technical and Administrative Services Corps.

Infact, na di name of one military camp, and dem dey call di troops wey base for dia by di same name.

Di camp na part of di army administrative, technical, and personnel services.

Dia troops no be frontline combat unit, but dem dey key to di military internal structure, logistics, and support operations.

Di camp dey strategically located near Antananarivo. Dis, plus dia size and arms depot, give dem correct political and military clout.

For 2009, CAPSAT na di site of one mutiny, wey partly dey against how di den-President President Marc Ravalomana govment bin take handle mass protests.

Di mutiny na key to di removal of Ravalomanana, and di rise of Andry Rajoelina.

Now, CAPSAT don rise against Rajoelina afta m govment chop accuse say dem use too much force to stop di protests.

Di paramilitary gendarmes bin form di backbone of Rajoelina support, and reports dey on Saturday and Sunday say dem get hand for di shoot-outs wit CAPSAT sojas near dia camp.

Wia Andry Rajoelina dey?

Rajoelina wiabout dey unknown, but e bin tok say im dey hide for one "safe place" following one alleged attempt on im life by "military personnel and politicians".

CAPSAT don deny say dem get hand for inside di mata.

Unconfirmed reports say one French military aircraft fly di president out of di kontri.

On Tuesday, US state department bin ask all sides "to pursue a peaceful solution in line wit di constitutional order".

Col Randrianirina tell BBC say Madagascar na "kontri wia kasala dey burst anyhow right now".

"Chaos bicos president no dey – e don go abroad."

Who be Col Michael Randrianirina - di new military leader for Madagascar

Colonel Michael Randrianirina na Malagasy military officer wey Madagascar confam as di new kontri leader afta protests wey lead to di removal of Rajoelina.

According to reports, e bin serve as head of di Androy region between 2016 and 2018, during di presidency of Hery Rajaonarimampianina.

E come serve as di army corps commander for Toliara until July 2022

E later become di head of di elite team, CAPSAT.

How di whole mata take start

Di unrest start just ova two weeks ago, afta one youth-led movement begin dey protest against serious water and power cuts across di kontri.

Di demonstrations soon escalate, to show wider dissatisfaction wit Rajoelina govment ova high unemployment, corruption plus di cost-of-living crisis.

Protestors bin clash wit security forces wey result in di death of at least 22 pipo and more dan100 odas injure, according to UN, although di Malagasy govment don dismiss di figures and describe dem as "rumours and misinformation".

Kontri pipo bi once see President Rajoelina, wey be entrepreneur and former DJ, as fresh start for Madagascar.

Di leader wey get baby-face become president wen e just be 34-year-old. E earn di title of Africa youngest leader, and e rule di kontri for four years, bifor e return to power afta di 2018 election.

But e fall out of favour afta allegations of cronyism and corruption, wey e deny.

Despite di fact say e be like say power don shift away from am, e don continue to try to influence events.

Rajoelina bin try dissolve di national assembly bifor di opposition go fit vote to strip am of im presidency for abandonment of post, but dat no work.

Lawmakers vote to impeach Rajoelina by 130 votes to one blank ballot on Tuesday. Even members of im party, Irmar, vote well-well to impeach am.

Rajoelina don reject di vote, e call am "null and void".

Di African Union (AU) don warn against sojas "meddling" in Madagascar political affairs and e reject "any attempt at unconstitutional changes of govment".

French President Emmanuel Macron call di situation "greatly worrying".

Di island don go through plenty series of political palava in recent years.

Madagascar na one of di poorest kontris for di world, as 75% of dia 30 million population dey live below di poverty line, according to di World Bank.



'We don seize power,' head of di military unit tok



Head of Madagascar military unit deny plot to kill president Rajoelina



Youth-led protests begin over electricity cuts and water shortages

Source: BBC