BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Wetin be ChatGPT and GPT-4 wey evri body dey tok about

Hoton alama

Wed, 15 Mar 2023 Source: BBC

OpenAI, di company behind di viral chatbot ChatGPT, don release new version of dia artificial intelligence system.

Dis release dey come few months afta dem first launch ChatGPT for November 2022.

But di artificial intelligence research lab, OpenAI say GPT-4 dey more creative, less likely to make up facts and less biased dan di one wey dey before, dat na ChatGPT.

As many pipo dey tok and search about ChatGPT and GPT-4, some odas dey wonder wetin dem be? and why so much tok-tok about dem all of a sudden?

Wetin be ChatGPT?

ChatGPT na Artificial Intelligence Technology chatbot wey OpenAI company found and launch for November 2022.

OpenAI na artificial intelligence research firm wey im founders include Elon Musk.

Artificial Intelligence (AI) Technology chatbots dey designed to answer questions and find information. ChatGPT na di best-known example.

E fit write essays, scripts, poems, and solve computer coding as human-like way. E fit also do conversations and admit mistakes.

Di GPT stand for Generative Pre-Trained Transformer. Dis mean say e dey learn wetin to tok by capturing information from di internet.

E go come use all of dis information wey e gada from di internet to "generate" responses to questions or commands wey pesin ask.

Millions of pipo don dey use ChatGPT since dem bin launch am for November 2022.

Popular requests for am include writing songs, poems, marketing copy, computer code, and helping with homework - although teachers say make students no use am.

ChatGPT dey answer questions using natural human-like language, and e fit also mimic oda writing styles like songwriters and authors, using internet.

But concerns dey ground say e fit one day take ova many jobs wey human being dey currently do.

Wetin be GPT-4?

GPT-4 na di newest version of OpenAI large language model systems, wey dem train to predict di next word for sentence by putting plenti amounts of text from di internet and finding patterns through trial and error.

OpenAI call GPT-4 “large multimodal model” because e fit accept text and images and respond in text.

What to expect from GPT-4?

Di new model fit respond to images - providing recipe suggestions from fotos of ingredients, for example, plus writing captions and descriptions.

E fit also process up to 25,000 words, about eight times as many as ChatGPT wey be just 3,000 words.

OpenAI say dem don spent six months on safety features for GPT-4, and don train am on human feedback.

However dem warn say e fit still dey prone to sharing disinformation.

GPT-4 go first dey available to ChatGPT Plus subscribers, wey pay $20 per month for premium access to di service.

E already dey power Microsoft Bing search engine platform. Di tech giant don invest $10b into OpenAI.

For one live demonstration, e generate answer to one complicated tax query - although no way dey to verify di answer.

GPT-4, like ChatGPT, na one type of generative artificial intelligence. Generative AI use algorithms and predictive text to create new content based on prompts.

GPT-4 get "more advanced reasoning skills" than ChatGPT, OpenAI tok.

Di model can, for example, find available meeting times for three schedules.

OpenAI also announce new partnerships with language learning app Duolingo and Be My Eyes, one application for di visually impaired, to create AI Chatbots wey fit assist dia users using natural language.

However, like di one before am, OpenAI don warn say GPT-4 still not dey fully reliable and fit "hallucinate" - dat na one phenomenon where AI invents facts or make reasoning errors.

Why pipo begin tok about AI and chatbots all of a sudden?

Di truth be say, e don tey wey Artificial Intelligence Technology (AI) don dey exist.

You sef don bin use some version of am wey dey inside software, search systems and smart speakers.

Na AI Technology you dey use wen you unlock your phone with facial recognition, do Google search or use spell-checking software.

But with di tier rubber of ChatGPT to di public for November 2022, many pipo dey surprise with how far di Technology don go and di simple way e dey interract with users.

Di competition come even serious as Google reaveal dia planned Artificial Intelligence (AI) powered chatbot wey dem call Bard to rival ChatGPT.

Microsoft release one chatbot within search engine Bing wey dem develope with OpenAI.

Meta wey be owners of Facebook, WhatsApp and Instagram, launch dia version wey dem call, Blenderbot.

One Chinese version also dey wey dem call Ernie, wey dey created by one company, Baidu.

Meanwhile, Some news articles and celebrities dey worry say ChatGPT go "end homework", afta Elon Musk tweet say "na new world. Goodbye homework!"

While ChatGPT fit answer questions wey fit help you out with homework, e fit no always give di correct facts.

Dis na because e main purpose na to create sentences wey maybe na human beign write am - instead of searching di internet for facts.

Dis mean say e fit sometimes get things wrong, and dis no go dey good for homework.

Source: BBC