Menu

Wetin be di court order to police on di enforcement of di tinted glass permit?

Screenshot 2025 10 03 185546.png A car we get tinted glass

Fri, 3 Oct 2025 Source: BBC

One Federal High Court for Warri, Delta State don order di Nigeria Police Force and di Inspector General of Police make dem match break for di enforcement of di tinted glass permit for pipo wey get motor.

Di court ask make di police and di IGP maintain and "respect judicial processes until more proceedings don happun concerning di mata".

Dis judgement wey happun on Friday dey come from case wey John Aikpokpo-Martins carry di Inspector General of Police and di Nigeria Police Force go court.

Oga Aikpokpo-Martins carry di mata go court to challenge weda di new tinted permit enforcement dey legal.

For di for now order, court direct police authorities make dem respect di court processes.

Di pesin wey lead di legal team for di petitioner, Senior Advocate Kunle Edun confam di mata give tori pipo say na major step to make sure say di rule of law dey uphelp.

Dis dey come even as tori dey come say dem don start to dey check pipo for dia tinted glass permit for states like Niger state from Friday.

Di Delta Police force reveal say dem don seize 25 cars on top di new order.

Wetin Police tok about di tinted glass permit law

According to di Police tok-tok pesin, Benjamin Hundeyin di mata of permit to get tinted glasses for motor, no be dem bring am.

E tell BBC News Pidgin say, "No be we make di law. Di law don dey say anybodi wey go tint im glass for im motor musto get permit.

"Di law dey, so we gatz enforce dat law to make sure say anybodi wey cover im glass, we we no fit see inside im motor, at least we go get im details."

Di Nigerian Police bin give motorists till October 2 to go get permission for dia tinted glass for dia motor.

Oga Hundeyin add say, "Bicos if we no do am like dat, many pipo go dey use all dis tinted glass motor take commit crime. Dem fit use am kidnap pesin we no go know, who be who."

Tinted permit na sometin motorist gatz dey do evri year and to get di permit go cost 14 thousand naira.

So wetin bring di mata of tinted glass permit?

According to Section 3 of the Motor Vehicles (Prohibition of Tinted Glass) Act, na di duty of di buyer or importer of di motor wit di tinted, shaded, coloured, darkened or treated glass to change am withing 14 days afta dem bring di car come Nigeria or dem buy di motor.

Section one of di same law tok say, except wit permission from di IGP, pesin no suppose get glass for dia motor wey dey tinted, shaded, coloured, darkened or treated in di way wey go make pipo or di objects wey dey inside motor to no dey visible.

Dis decree don dey ground since 1991.

Na for April, Police bin first announce say dem go start to dey give tinted glass permits nationwide wit dia Police Specialised Services Automation Project afta dem bin match break on top di mata for 2022.

Dem bin give pipo till August to get dia papers togeda pifor dem come increase di time to October 2nd,



Source: BBC