BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Wetin be di flesh-eating sickness wey increase for US after Hurricane

64051202 File photo

Wed, 19 Oct 2022 Source: BBC

Di Florida county wey Hurricane Ian worry last month don begin witness increase in cases of flesh-eating bacteria illnesses and deaths. Officials say Lee County, where di category four storm land on 28 September, don record 29 illnesses and four deaths as result to di bacteria. All but two cases dey discover afta hurricane. Vibrio vulnificus infections wey also dey known as "flesh-eating bacteria ", fit affect pesin afta di bacteria enta di body through open cuts. Di bacteria dey live for warm brackish water, like standing floodwaters. One spokesperson for di county health department tok on Monday say: "Di Florida Department of Health in Lee County dey observe one abnormal increase in cases of Vibrio vulnificus infections as a result of exposure to di floodwaters and standing waters afta Hurricane Ian." Di statement call on residents to "always dey aware of di potential risks associated wen exposing open wounds, cuts, or scratches on di skin to warm, brackish, or salt water". "Sewage spills, like those wey Hurricane Ian cause, fit increase bacteria levels," di statement continue. "As di afta-storm situation continue, pipo need to take care against infection and illness wey Vibrio vulnificus dey cause." Collier County, just south of Lee County, don also recorde three confam cases wey officials say dey storm-related. Across Florida, dem get record of 11 confam deaths wey dey link to di bacterium dis year, and a total of 65 cases, according to state health data. Officials estimate say nearly half dey related to Hurricane Ian. For 2021, 10 deaths na im dem record and 34 cases for Florida. Seven deaths dey link to di bacteria for 2020. Vibrio vulnificus dey known as "flesh-eating" because e fit develop into necrotising fasciitis, one condition wey dey cause tissue to break down. No be di only bacteria wey fit cause necrotising fasciitis. According to di US Centers for Disease Control and Prevention, around one in five Vibrio vulnificus patients dey die, sometimes within only a day or two wen dem fall ill. E fit cause sepsis if e enta di bloodstream, and fit sometimes lead to amputations to prevent dia spread to oda parts of di patient body.

Source: BBC