BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Wetin make Kenya youths go back to di streets as Ruto swear in new cabinet

Fb7c1250 55a2 11ef Af28 B5a98fe08607.png Kenyan protesters

Thu, 8 Aug 2024 Source: BBC

Kenya Police attempt to arrest political activist, Kasmuel McOure, as dem throw teargas to scatter anti-govment protesters wey come out to march for better goment for di kontri capital, Nairobi.

Local troi pipo dey report say Kasmuel McOure run comot for di protest ground as police try catch am during di protest.

Small groups of Kenya youths bin come out again on Thursday 8 August, even as President Ruto bin dey swear in im new cabinet.

Different businesses for di city of Nairobi bin close and public transport no work during di time of di protest.

Police bin also put roadblocks for major roads to stop protesters make dem no fit waka go di central business district.

Ruto appoint senior opposition officials to im cabinet, as move to cool di anger of di public against im goment.

Im bin give four posts to di opposition - including di powerful finance and energy ministries.

Ruto swear in dis new cabinet early on Thursday inside heavy security for im official residence, State House, wey protesters bin threaten to invade.

During di ceremony, Ruto say im new cabinet "cannot and must not fail Kenya pipo".

Im describe in new cabinet as "alliance of rivals" wey for long don suffer "factional and sectarian competition”.

“More dan ever, e clear say we dey fully united by shared devotion to secure a prosperous Kenyawey go serve us all," im add.

Dis new demonstrations na di continuation of di anti-tax protest wey don make di president do several changes for di kontri.

Di previous protest bin force di goment of President William Ruto to cancel di finance Bill 2024, and also dissolve im cabinet.

For June 2024 wen di last protest bin happun, president Ruto claim say 'criminals' bin hijack di anti-tax protests wey dey happun now for im kontri.

Ruto tok say organised criminals don "enta and hijack," di anti-tax protest as im bin dey address di violent I-no-go-gree wey bin occur on Tuesday.

"E dey very painful for Kenya say dangerous pipo don hijack conversation wey important like dis," im kontinu.

"E no dey in order say criminals wey dey pretend to be peaceful protestors fit raise terror against di pipo - and expect to go scot free."

E say im goment don deploy all available resources to fight di pipo wey dey "undermine di security of di kontri".

Source: BBC