Trump dey ready to hold one news conference by 10:00 in Washington DC
Di US and UK dey expected to announce one deal to reduce tariffs today.
UK goment don dey call for deal to bring down di tariffs since President Trump sama tariffs on almost evri kontri for di world last month.
President Trump dey in line wit di agreement wen e post on social media on Wednesday night, 7 May say im go announce one "major trade deal" wit one "highly respected kontri".
Downing Street also confam say di trade deal go happun.
On 2 April, Trump bin declare sharp tariffs on dozens of trading partners, bifor e announce one 90-day pause on di levies.
Goments from all ova di world don dey try to strike deals wit Washington bifor di new deadline pass.
US sama 10% global tariff for almost evri kontri for di world, wey include UK, wey be long-time ally of America.
Oga Trump also sama UK 25% US import tax on steel, aluminium and cars.
Washington dey close to agreeing to trade deals wit India and Israel, according to reports.
Di administration also still dey in toks wit several oda kontris including Japan, South Korea and Vietnam.
Trump bin tok say im want make nations strike new deals wit di US as e try to radically reshape di global trading system.