Di new IGP Christian Tetteh Yohuno don dey for di police for ova 40 years
Ghana President John Mahama don continue to dey appoint pipo wey dey form im goment afta im win di 7 December elections.
So far di president don select 56 ministers and deputy ministers as im promise say im go use only 60 ministers to lead di kontri - "to cut cost and ensure efficiency".
Aside di ministers and oda officials for state agencies, President Mahama also don dey change im top security pipo.
Na so im appoint COP Christian Tetteh Yohuno as di new Inspector General of Police (IGP).
Many pipo bin dey expect say di new president afta im win di elections, go immediately remove di security chiefs and odas.
Inside letter wia tok-tok pesin for goment Felix Kwakye Ofosu release on Thursday night, im tok say "in accordance wit article 91 and 202 of di constitution and afta consultation wit di council of state, di president bin appoint COP Christian Yohuno as IGP."
COP Yohuno replace Dr George Akuffo Dampare wey be IGP from 2021 to 2025.
At di time wey former president Nana Akufo-Addo appoint oga Dampare, na im be di youngest IGP.
E also serve as aide-de-camp for di late Ghana president Professor Evans Atta-Mills wen im be vice president between 1997 - 2001.
Many pipo bin tok say for im four years as IGP, Dr Dampare don cause some changes for di police service - wey include say im try to improve di relation between di police and di public, im renovate di police headquarters wit new facilities wey im introduce di K-9 unit and horse patrol operation of di police to improve visibility.
Despite dis tins, many pipo bin tok say im fail to investigate di 2020 and 2024 election violence wey togeda kill more dan 15 citizens.
President John Mahama afta im assume office as president bin direct di IGP say make im investigate di deaths during dis two elections and submit report to di presidency.
But dat neva happun until dem remove am from office wey dem appoint new IGP.
During di tenure of IGP Dampare also, im prevent senior police officers and commanders for di various regions and districts for di kontri from granting interviews to di media about tins wey dey happun for dia jurisdiction.
Afta tori comot say dem sack am, some police officers for di various barracks bin dey celebrate say "freedom don come now, we dey free forever."
Inside one video for social media, some officers bin dey chant and sing say "we thank God say president Mahama don hear our prayer. Di joy dey everywhere. At long last."
Inside di letter from di presidency wey announce di new IGP, dem tok say "COP Yohuno dey bring 40 years experience to di position of IGP wey im dey expected to oversee di modernisation and transformation of di police service."
Dem promote am to di rank of commissioner of police on 1 January 2016.
For 2011 dem select am to di rank as deputy commissioner of police (DCOP).
Di new IGP bin serve in di past as director general for di motor traffic and transport department (MTTD) wia im implement reforms for di safety on di road.
Im also work as director general of administration for di service.
IGP Tetteh Yohuno dey enter office to improve law enforcement, professionalism and to restore public confidence for di service.
Under Dr George Akuffo Dampare, dem arrest protesters wey dem put dem for court
Dr George Akuffo Dampare bin serve as IGP from 2021 to 2025
COP Tetteh Yohuno get one year bifor he go retire for di service