Menu

Wetin we know about Hezbollah drone attack wey kill Israeli soldiers

Screenshot 2024 10 14 162141.png UN accuse Israel say dem force dia way into one peacekeeping base for southern Lebanon

Mon, 14 Oct 2024 Source: BBC

Hezbollah drone attack kill four Israeli sojas for Israeli army base wey dey south of Haifa on Sunday night.

Dis na one of di deadliest attacks against Israel by Hezbollah since ova one year of dia fight-fight.

Di attack hit one base near Binyamina, one town wey dey around 20 miles (33km) south of Haifa. More dan 50 sojas wunjure for di attack.

Hezbollah, di Iran-backed armed group, say na dem carry out di attack, e say e bin dey target one training camp for IDF Golani Brigade wey dey di area, e dey based between Haifa and Tel Aviv.

Di attack, di armed group say, na response to deadly strikes by Israel fot southern Lebanon and di capital Beirut.

So dis na wetin we know so far:

On Sunday night, Hezbollah drone strike kill four Israeli sojas for one military base for Binyamina, south of Haifa. More than 50 other soldiers were injured

Israel still dey attack Gaza, tori be say at least 15 pipo die for inside one attack for school wey hundreds of displaced Palestinians dey stay on Sunday. Israel Defense Forces neva tok pim for di mata - but dem previously bin accuse Hamas say dem dey use civilian shelters as military bases

For di Israel-Lebanon border, di UN Interim Force in Lebanon (Unifil) say Israeli tanks forced dia way enta di main gate of one of dia positions. Di organisation say dem fire shots toward di camp, e cause minor injuries to 15 peacekeepers. Di IDF offer a different version of events - and add say e approach di Unfil camp to evacuate two "seriously injured" sojas.

Peacekeepers say Israel forces, force dia way to UN base for Lebanon

UN accuse Israel say dem force dia way into one peacekeeping base for southern Lebanon – dis na di latest gbas-gbos between UN Interim Force in Lebanon (Unifil) and Israeli forces.

According to Unifil, two Israel Defense Forces (IDF) tank destroy di base main gate on Sunday and later dem fire rounds nearby – e cause smoke to enta di camp wey leave 15 peacekeepers wit skin irritations and gastrointestinal reactions.

Di IDF say dem encroache on a Unifil position in order to evacuate injured sojas.

Israel don tell di peacekeeping force plenty times to withdraw from areas of southern Lebanon - wia fight-fight dey take place. Unifil so far don refuse dis requests.

Nearly 10,000 UN peacekeepers from 50 kontris dey stationed for Lebanon, alongside around 800 civilian staff.

Na since 1978, dem don patrol di area between di Litani River and di UN-recognised boundary between Lebanon and Israel wey dey known as "Blue Line".

Hezbollah drone no activate alarms

Throughout Sunday evening, television bulletins, social media posts and online reports show video of emergency vehicles, including helicopters, wey dey carry casualties go hospitals across northern Israel.

Israeli censorship rules initially bin prevent media outlets to say exactly where or wetin dem hit. But eventually, one army tok-tok pesin say di target na army base in Binyamina.

Di tok-tok pesin say four sojas die, for wetin be one of di biggest attacks against Israeli position since di start of di war more than a year ago.

A low-level drone, or UAV, wey dem launch from Lebanon na many believe say dem use for di attack - na relatively unsophisticated weapon wey no appear to activate early warning alarms.

Some details still dey scarce but many of di injured dem say bin dey for one communal canteen wen e happun and dem catch dem by surprise.

Different calculation

Especially wen e come to di latest escalation, e no go wrong to assume say Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu dey operate outside Israeli political mainstream. If anything, di pressure on am dey tougher to strike harder against Hezbollah, but also Iran.

Wen US and France last month suggest di ceasefire plan for Lebanon, criticism of di proposed 21-day truce bin come from di opposition, and di main left-wing grouping for Israel, as well as di right-wing parties.

Israel dey determined to kotinu dia wars now, no be becos e feel say e fit withstand international pressure, but also because Israel tolerance of di threats e dey face don shift afta 7 October.

For years, hezbollah plan na to invade Galilee for northern Israel. Now wey Israeli public don experience di reality of gunmen wey dem enta dia homes ,dat threat dem no fit contain am, dem must remove. am

Israel perception of risk don also change. Di long-held notions of military red lines for di region don evaporate. Dem don commit several acts in di past year wey for, until recently, lead to an all-out conflict, raining bombs and missiles on Tehran, Beirut, Tel Aviv and Jerusalem.

Israel don kill di head of Hamas while im be guest of di Iranians for Tehran; e don also kill the entire leadership of Hezbollah, including Hassan Nasrallah; e don assassinate senior Iranian officials inside diplomatic buildings for Syria.

Hezbollah don fire more dan 9,000 missiles, rockets and drones for Israeli cities, including ballistic missiles for Tel Aviv. Di Iranian-backed Houthis in Yemen don also launch large missiles for Israel cities, Israeli defences don intercept by as dem re-enter di Earth atmosphere above central Israel. Iran don launch not one, but two attacks against Israel in di past six months involving more dan 500 drones and missiles. Israel don invade Lebanon.

Source: BBC